You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Chinda, Hamzat, Alli, Adelabu - di big winners and losers for APC govnorship primaries
Di All Progressives Congress (APC) don hold dia primaries on Thursday, 21 May wia some anointed aspirants emerge as govnorship candidates wey go represent di party for di 2027 general elections.
Di primaries dey come a day afta di party hold dia state assembly primaries on Wednesday, 20 May.
Bifor di primaries begin, some aspirants for different states begin withdraw from di race and leave dia opponents as sole contenders for di tickets.
Most first-term govnors of di APC secure return tickets, while several govnors wey dia tenure dey expire successfully deliver dia preferred successors in consensus-driven primaries across di kontri.
Rivers State
House of Representative Member Kingsley Ogundu Chinda emerge as APC governorship candidate for Rivers State.
Di APC govnorship primaries committee announce emergence of Chinda for di party State Secretariat for Port Harcourt, di state capital.
Chinda poll 268,497 votes to emerge di party candidate for di state.
Govnor Siminalayi Fubara na one of di APC govnorship aspirants for Rivers State bifor e withdraw from di race.
For statement wey e sign by imsef bifor di primaries, Fubara say e go support whoever go emerge as di candidate of di party.
E say leadership dey about sacrifice and "e get wen time go come wey personal ambition must submit to di greater good of di pipo".
Govnor Fubara say Rivers State big pass any individual and for dis critical moment, "di peace, stability and unity of our dear state must take precedence ova evri personal interest".
Govnor Fubara na di second pesin to step aside from di APC govnorship primaries for Rivers State afta Tonye Cole.
Alabo George-Kelly also withdraw from di APC govnorship primaries for di state afta Govnor Fubara withdrawal.
George-Kelly say im withdrawal dey come afta one stakeholders meeting by di APC national leadership wia dem discuss party unity and strategy for Rivers State.
E add say consultation wit im political team and oda stakeholders also shape di decision.
George-Kelly describe imsef as member of di Rivers State Rainbow Coalition for President Bola Tinubu wey dey work under di leadership of di FCT Minister Nyesom Wike.
Lagos State
Lagos State Deputy Govnor Obafemi Hamzat na im emerge as di candidate of di party afta e defeat Jim-Kamal.
Hamzat get di backing of President Bola Tinubu and Govnor Babajide Sanwo-Olu.
Samuel Ajose wey bin also wan contest for di ticket withdraw from di race.
Ajose, wey pipo sabi as SMA Gold, say e step down to accept di wishes of APC leaders ahead of di party primaries.
"Di race don dey veri interesting and e dey come to emotional end yesterday for di phase of SMA for di 2027 election," e tok.
Oyo State
Na Senator Sarafadeen Alli emerge as di Oyo State APC govnorship candidate afta e secure 578,143 votes.
Senator Abdulfatai Buhari get 37,265 votes, while former Minister of Power, Adebayo Adelabu, get 19,193 votes.
Na about 11 aspirants bin hustle for di ticket and eight of dem come from Ibadan, di state capital, while two of dem come from Oke Ogun axis and one from Ogbomoso.
Oda aspirants include Dr Adewale Kareem, Barrister Akeem Agbaje, Engineer Akeem Alao, Dr Ayobami Lam-Adesina, Prince Asanke Asatola and Ololade Usman, Dr Muyiwa Gbadegesin, and former Deputy govnor Engineer Rauf Olaniyan.
Ogun State
Na Senator Solomon Olamilekan Adeola wey pipo sabi as Yayi emerge as di govnorship candidate of di APC for Ogun State.
Adeola na serving senator wey dey represent Ogun West Senatorial District for di National Assembly.
Oda winners
• Kano APC affirm Yusuf as sole consensus candidate.
• Uba Sani secures Kaduna ticket with 459,393 votes.
• Sheriff Oborevwori poll 345,375 votes for Delta primaries.
• Babagana Zulum and Vice President Kashim Shettima back Mustapha Gubio to get di APC ticket for Borno State govnorship election.
• Enugu members affirm Mbah as consensus sole aspirant wey emerge as di candidate.
• Sokoto, Niger, Katsina govs secure affirmation tickets.