You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
President Tinubu appoint 39-year-old professor as Jamb registrar to replace Oloyede
Nigeria President Bola Tinubu don announce di appointment of Professor Segun Aina as di new Registrar of di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb).
Di new Jamb registrar go replace Professor Is-haq Oloyede wey im two-term tenure go expire on 31, July 2026.
According to di statement by di President tok-tok pesin Bayo Onanuga, di appointment of Segun Aina go now make history as Jamb youngest registrar.
According to di presidency, e dey expected say Oga Aina go bring im experience and knowledge into di operations of di Board.
President Tinubu also want make di new Jamb registrar make di educational organisation pass wetin im predecessor achieve.
Prof Oloyede bin assume duty as di registrar of Jamb on 9 August, 2016.
Who be Professor Segun Aina
According to di presidency, Professor Aina go clock 40 years by July, and im appointment go make am di youngest registrar wey Jamb don get.
Oga Aina na Professor of Computer Engineering from Obafemi Awolowo University, Ile-Ife.
Aina get Bachelor of Engineering for Computer Systems Engineering from University of Kent, e get MSc in Internet Computing and Network Security.
E also get PhD in Digital Signal Processing, wey di two na from Loughborough University, United Kingdom and e complete di Senior Management Programme from Lagos Business School.
Aina begin im career wit Jamb during National Youth Service wia e gain foundational experience for national admissions and dat don help get contributions to examination reform.
Professor Aina get ova 15 years of post-graduation experience, as e get experience for technology, policy, and institutional transformation wia e advise federal and state govments on digital transition.
At di age of 39, e become one of Nigeria youngest Computer Engineering professors.
Bifor im appointment as Jamb registrar, Aina serve as consultant to major examination bodis, including Neco, Nabteb, and different state ministries of education.
E dey provide experience on ICT systems, examination integrity, and digital process optimisation, for di places wia e don work.
Professor Aina na member of several professional bodis, including di Council for di Regulation of Engineering for Nigeria (COREN), di Nigerian Society of Engineers (NSE), di Institute of Electrical and Electronics Engineers (IEEE), and di Institution of Engineering and Technology (IET).