You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Court find Air France and Airbus guilty of manslaughter ova 2009 plane crash
- Author, Sofia Ferreira Santos
- Published
- Read am in 3 mins
Court find Air France and Airbus guilty of manslaughter ova 2009 plane crash wey kill 228 pipo.
Di Paris Appeals Court don find di airline and aircraft manufactuer guilty of corporate manslaughter for dis incident, wia flight AF447 wey dey go from Rio de Janeiro to Paris crash into di Atlantic Ocean.
Di passenger jet no fit fly again during di storm and fall inside di water, e kill everybody wey dey on board.
One court bin clear di companies for April 2023 but afta dis appeal, dem don find dem guilty.
Airbus A330 just disappear from radar during di storm for 1 June 2009, and dem find am damaged afta long search of 10,000 sq km (3,860 sq miles) for sea floor.
Di black box show up afta months of deep-sea search in 2011.
All 12 crew members and 216 passengers wey dey on board die wen di plane crash into sea from 38,000ft (11,580m) height, dis na di deadliest incident for French aviation history.
Relatives of some passengers, mostly French, Brazilian, and German nationals, gada to hear di verdict on Thursday.
Di court ask di companies make dem pay di maximum fine, €225,000 ($261,720; £194,500) each - but some of di victims families don tok say di amount na just token penalty.
However, di ruling fit cause damage to di companies reputation.
During dia closing argument for November, di deputy prosecutors tok say di companies' behavior no dey acceptable, e accuse dem of "spouting nonsense and pulling arguments out of thin air."
Both Airbus and Air France don deny di charges, and French lawyers believe say dem go still launch more appeals.
Di BBC don contact Airbus and Air France for comment.
Di crash cause serious recovery operation for remote part of di Atlantic Ocean, more dan 700 miles (1127km) from di coat of South America.
During di initial search, di French govment dey responsible to investigate di crash while Brazilian forces take charge to find di bodies.
For di first 26 days of search, dem recover 51 bodies, many still dey buckle into dia seats.
One family member wey tok to BBC News Brasil for 2019 tok say im bury im son body two years afta di incident happun.
Di son, na 40-year-old engineer Nelson Marinho Filho, almost miss di flight from Rio de Janeiro's Galeão International Airport, and na im be di last person wey board, according to Air France staff.