Nigerian Army narrate how dem rescue Oyo kidnap victims, President Tinubu reveal dose behind di abduction

Soldiers wit bulletproof

Wia dis foto come from, Nigerian Army

Published
Read am in 5 mins

Nigerian military narrate how dem rescue 40 pupils and teachers wey terrorists kidnap from Oriire Local Government Area of Oyo State for 15 May 2026.

Dem give dis narration afta videos and fotos of di kidnap victims begin dey show all ova social media afta tok tok pesin to Nigerian President Bayo Onanuga post am to announce di return of di victims.

Di army say na combined military operations wit plenti oda security agencies help dem carry out di operations

Alreadi, President Bola Tinubu say dem no pay any ransom and dem no do agreement wit di jaguda pipo.

Na on 10 July, 2026 tori of di release of di abducted school children and teachers bin spread afta di govment announce say dem don regain freedom, 56 days afta dia abduction from dia schools for Oriire community for Ogbomoso, Oyo State.

Di govment say dem secure di release of di abducted children and dia teachers witout any collateral damage.

Di presido also confam di arrest eight of di kidnappers and say dem kpai odas wey get hand for di operation.

Howeva, as army give details of how di rescue operation happun, president Tinubu also name dose wey dey behind di abduction.

How army rescue di oyo kidnap victims

According to Lieutenant Colonel Danjuma Jonah Danjuma, wey be di Acting Deputy Director of 2 Division Army Public Relations, e give account of di operation.

E say di operation last for more dan one month as dem begin dey identify di leaders of dose wey carry out di kidnap.

E say begin burst di terrorist and dia informants inclduing wia dem begin dey hide for di forest.

"Di operations, wey last for more dan a month, focus on identifying di terrorists kingpins wey mastermind di kidnapping, bursting and dismantling dia networks and logistics links, including dia informants and hideouts wey dey located within di Old Oyo National Park Forest, Oyo State."

Di military say dem make multiple arrests for different parts of di states and scatta di group wit plenti pressure.

"As part of di operations, we make multiple arrests within Oyo State and for oda locations across some states for di kontri."

"Dis arrests completely disorganize di group, wey put pressure on dem and lead di terrorist group to unconditionally release di pupils and teachers."

Di military say dem do di operation to ensure say di children and teachers dey safe, but some of di security officers injure.

Military officers inside bush wit helmet

Wia dis foto come from, Nigerian Army

Who dey behind oyo kidnapping- Tinubu reveal

Nigerian president Tinubu don name di terrorists group wey dey behind di Oyo kidnapping.

Oga Tinubu say na di Ansaru terrorists carry out di abduction of di schoolchildren and teachers for Oriire community.

"Di children and teachers abducted by Ansaru terrorists for Oyo State now dey rescued by our security forces, alive and unharmed."

Di Ansaru terrorists don carry out sveral oda abductions and attacks for Nigeria, including jailbreak sef.

Who be di Ansaru terrorists?

For November 2013, di US designat Nigeria Boko Haram and Ansaru militant groups as foreign terrorist organisations.

E mean say say US regulatory agencies dey instructed to block business and financial transactions wit di groups.

Boko Haram don chop plenti blame for thousands of deaths while Ansaru na one of di off-shoot of Boko Haram.

Dem form Ansaru for January 2012, and dem begin rise since den wit several attacks.

Di UK list Ansaru as "terrorist group" linked to al-Qaeda for di Islamic Maghreb (AQIM).

For December 2012, about 30 Ansaru gunmen used dynamite to force dia way into one compound, wia dem kidnap French national Francis Colump for Katsina.

Dem carry out similar attack for February 2013, wia dem capture seven foreign nationals from housing compound owned by the Lebanese construction company Setraco.

Ansaru also dey carry out attacks on Nigerian targets.

For January 2013, Ansaru say dem carry out attack wey kill two Nigerian soldiers as dem dey prepare to deploy to Mali.

For 2025, Di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, don announce say di Nigeria security forces gbab two top Ansaru terrorist group leaders wey e identify as Abu Baraa, di Amir, and Mahmuda, di deputy Amir.

Ribadu yarn dis one for press briefing on security developments for di Office of di National Security Adviser.

Di NSA say na dis two men dey responsible for planning several terrorist operations for Nigeria and high-profile kidnappings.

According to di NSA di two men don dey ontop Nigeria most wanted list for years, afta dem jointly lead multiple attacks on civilians, security forces, and critical infrastructure.

For September 2025, Justice Emeka Nwite of di federal high court don sama 15 years prison sentence on top one Mahmud Usman wey di Departrment of State Services bin arraign for court on charges of terrorism.

According to di DSS, Usman na commander for Ansaru terrorist organisation, and dia work na to dey engage for illegal mining from wia dem dey get moni to dey buy dia weapons.