South African player Jayden Adams don die at age 25 afta World Cup appearance

Wia dis foto come from, Ulrik Pedersen/NurPhoto via Getty Images)
South African national mens team midfielder Jayden Adams don die at di age of 25.
Adams na also player for South Africa based club Mamelodi Sundowns wey dey also hold di midfield for dem.
Di 25-year-old South African midfielder pass away, afta e feature for three matches wey di Bafana Bafana play for di 2026 Fifa World Cup.
"Na wit profound shock and heavy heart dat I learn of di passing of Jayden Adams," South Africa minister of sport, arts and culture Gayton McKenzie say for statement.
Di sport minister also post for im X page 'Rest in perfect Peace my Boy', wit di video of wen e dey shake Jayden.
South Africa make history as dem reach di World Cup knockout phase for di first time sake of dia victory ova South Korea afta Thapelo Maseko second-half strike.
Jayden play for dat game and all previous group stages game.
Di midfielder make three appearances for di 2026 World Cup tournament, but di news of di death of im grandmother come a day bifor di match against Czech Republic.
End of Di one wey oda users dey read well well
South African Football Association (SAFA) confam and announce di death of di Bafana Bafana midfielder Jayden Adam's grandmother, Marianna.
Adams pass away few weeks afta di death of im grandma.
Di football association say Jayden start for di match against Czechia and give im all while e dey carry di burden of losing im grandmother.
Di cause of Jayden Adams death neva dey clear to di public.
Condolences dey pour in for di late young midfielder Jayden Adams.
Wetin cause Jayden Adams death?
"South African football don lose one of di brightest young talents, and our nation mourns alongside im family, im team-mates and di millions of supporters wey watch am grow from promising academy prospect into full Bafana Bafana international."
Police for South Africa say dem don open investigation afta dem find di body of one 25-year-old man for house in Schotschekloof, suburb in central Cape Town, on Saturday morning.
McKenzie add say dem neva confam di cause of Jayden death.
"Di cause of Jayden passing no dey yet confam, and I wish to appeal to members of di media and di public to exercise restraint and compassion, and to refrain from speculation, while im family and Mamelodi Sundowns get di space and privacy dem need at dis incredibly difficult time," South Africa sports minister say.
๐ ๐ฎ๐บ๐ฒ๐น๐ผ๐ฑ๐ถ ๐ฆ๐๐ป๐ฑ๐ผ๐๐ป๐, Stellenbosch and odas pay tribute to Jayden Adams
๐ ๐ฎ๐บ๐ฒ๐น๐ผ๐ฑ๐ถ ๐ฆ๐๐ป๐ฑ๐ผ๐๐ป๐ describe di death of Jayden Adams as '๐ฑ๐ฒ๐๐ฎ๐๐๐ฎ๐๐ฒ๐ฑ', as dem send tributes to di family.
"Na wit heartfelt sorrow dat Mamelodi Sundowns fit confam di passing of highly talented Bafana Bafana midfielder, Jayden Adams."
Di club express dia condolences to di family and friends while dem ask make pipo respect di family privacy.
On di oda side, Stellenbosch Football Club also send dia condolence afta dem hear of di death of dia former player, Jayden.
"Di Club wish to extend deepest condolences to Jayden family and loved ones, as well as everyone at Mamelodi Sundowns, and call for dia privacy to be respected during dis unimaginably difficult time."
Stellenbosch Football Club say dem go miss Jayden.
Profile of Jayden Adams
Jayden Adams na 25 years old Midfielder wey dey play for di Bafana Bafana of South Africa and Mamelodi Sundowns.
Dem born am for 5 May, 2001 and a South African nationality.
E join Mamelodi Sundowns for January, 2025, wia e dey known to dey create chances.
Dem describe am as youth product wey mature afta off-field challenges and South African coach Hugo Broos praise im growth.
Di ogbonge midfielder join Sundowns afta e complete a move from Stellenbosch.
Jayden establish imsef as one of fi Premier Soccer League best midfielders for South Africa.
Na from Stellenbosch academy e come, wia Adams sign im first professional contract for 2020 bifor e become key figure for di national team.
Local reports say Jayden make 139 appearances for di Cape Winelands club, di second most for dia history, bifor e secure move to di Brazilians.
During im time wit Stellenbosch, Jayden help di club win di 2023 Carling Knockout.
Wen e join Sundowns e kontinue im success, wia e win di Betway Premiership and CAF Champions League titles less than two years.
For di international stage, Adams na part of di Bafana squad wey claim bronze medal for di 2024 Africa Cup of Nations for Cรดte d'Ivoire.














