Pupils and teachers wey gunmen kidnap for Oyo State regain freedom, Tinubu assure dem of justice

Wia dis foto come from, @aonanuga1956/X
President Bola Tinubu don assure di children and teachers wey terrorists kidnap for Oyo state, southwest Nigeria, plus di family of di teacher wey dem murder for captivity, Michael Oyedokun, say im govment go get justice for dem.
Di Nigerian leader give dis assurance afta di announcement of di release of di abducted children and teachers on Friday, 10 July.
Di abducted school children and teachers bin regain freedom, 56 days afta dia abduction from dia schools for Oriire community for Ogbomoso, Oyo State, di Presidency tok.
For one statement wey tok-tok pesin to di President Bayo Onanuga issue, Oga Tinubu express joy for di successful rescue operation and hail di security forces for dia "heroic effort".
E say dem secure di release of di abducted children and dia teachers witout any collateral damage.
Di presido also confam di arrest eight of di kidnappers and say del kpai odas wey get hand for di operation.
"I happy well-well say our security forces successfully rescue di abducted pupils and teachers from Oriire, Ogbomoso for Oyo State today afta one military, police and intelligence-driven operation wey neutralise some of di terrorists wey carry out di evil act plus di arrest of eight of dem," Tinubu tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Earlier, Oga Onanuga bin tok say dem no give in to any special deal or exchange for di rescue operation wit di kidnapper.
"No exchange or special deal dey for dis rescue operation. Di kidnappers bin dey demand for di release of one terrorists, wey be Oga, but e currently dey face prosecution for all im sins," e tok.
Di presidency bin share videos and fotos of di released pupils and dia teachers.
For inside one video, wey Onanuga share along di statement, one of di kidnapped victims wey be principal dey tank President Bola Tinubu and security forces for dia release. Di schoolchildren for inside di video join di principal to shout, "Tank you, sir," wen she tok finish.
"Hello sir, our father, we dey grateful, di President sir, we dey grateful, we understand your commitment to our safety and we appreciate evritin wey you do for us. Tank you! All di security operatives try so much and dat na why we still dey alive. Tank you sir," she tok.
Di President don order emergency agencies to work wit di Oyo State govment to provide all necessary medical and relief support to di children and di teachers.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Makinde, odas welcome di release of abducted Oyo school teachers and children

Wia dis foto come from, Seyi Makinde/Facebook
Plenti reactions don follow di release of di abducted Oyo State teachers and school children.
Oyo State Govnor Seyi Makinde express joy at di safe return of di children and teachers jaguda pipo gbab from Oriire LGA 56 days ago.
"Our priority now na to reunite dem wit dia families and support dia rehabilitation afta dis traumatic experience," e tok.
Di Oyo State leader also hail di security agencies wey take part for di rescue operations for dia sacrifices.
Opposition Peoples Democratic Party (PDP) wey welcome di news of dia release, call on Nigeria govment to take decisive steps to ensure say such no happun again. "Di protection of lives and property na di first responsibility of govment and na di barest minimum wey our kontri and citizens deserve", di PDP tok for statement.
Bandits kpai one school teacher during di attack, and later also kpai anoda teacher inside di forest.
Di attack happun for Baptist Nursery and Primary School (Yawota), Community Grammar School (Esiele), and L.A. Primary School for Ahoro-Esinele, Oyo State.
Di govment bin blame di abductions on one faction of di Islamist militant group, Boko haram.
Di attack bin generate plenti reactions as many pipo para, members of di Nigerian Union of Teachers (NUT) plus oda stakeholders, wey dey demand urgent action bin protest and schools for Oyo State bin go on strike.
NUT bin describe di attacks as "barbaric and inhuman," and warn say continued attacks on schools fit force teachers nationwide to withdraw dia services.
More dan 1000 kilometres away for Mussa town, Askira Uba Local Govment of north-eastern Borno State, parents still dey mourn di absence of dia children.
Di situation wit di Borno schoolchildren neva dey clear, as di focus bin mostly dey on di Oyo school kidnap.










