BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Nigeria govment amend charges against former AGF Abubakar Malami, drop terrorism financing
Malami and in son Abdul Aziz Abubakar Malami bin dey stand trial for alleged abuse of office, illegal possession of firearms, and also accuse say e bin dey sponsor terrorism.
Pope Leo XIV in Cameroon: How di Catholic leader visit go hapun
Im visit dey come at a time wen di kontri dey struggle wit one conflict wey don go on for almost a decade for dia two Anglophone regions.
David Mark-led ADC expel Nafiu Bala, odas for alleged anti-party activities for National Convention
About 3000 delegates from di 36 States of Nigeria and di FCT, dey expected to gather for di Rainbow Events Centre, Abuja for di ADC national convention on Tuesday.
'Wen pipo start to run, di aircraft begin kpai dem' - Survivors of Nigerian Air Force airstrikes for Borno tok wetin dia eye see
Di survivors account dey come afta reports say di Nigerian military jets wey strike di village market kill many civilians.
Spain approve plan to give around 500,000 undocumented migrants legal status - how to dey eligible
Di govment plan na to offer one year, renewable residence permit give undocumented migrants.
Romuald Wadagni: Di 49-year-old chartered accountant wey be Benin next president
Provisional results show say Benin Finance Minister Romuald Wadagni win di presidency election wit very wide margin.
Why political stakeholders dey drag Inec chairman Joash Amupitan and dey call for im resignation
In recent times, Inec Chairman Joash Amupitan don enta news for different issues but majorly na sake of 2027 election and party issues.
US block Iranian ports as Trump say Tehran want make deal 'veri badly'
For one social media post, di US president warn say any Iranian "fast attack ships" wey dem catch dey try approach di blockade "go dey immediately ELIMINATED".
Terrorists kpai Brigadier General Oseni Braimah as Nigerian Army confam deaths of sojas for Borno
For one statement wey di Director of Defence Media Operations, Major General Michael Onoja, sign on Thursday 9 April, di military say di incident happun around 12:30 am for di Brigade Headquarters for Benisheikh.
Ginger Me
Special Tori
Five times wey Boko Haram kpai senior Nigerian military personnel for 2026
Dis no be di first time Boko Haram militants attack senior military officers wey dey fight di group for Borno State.
Who be Roelf Meyer wey South Africa name as new ambassador to di US
Roelf Meyer play key role as negotiator during di tok to end white-minority rule for South Africa.
'I want pipo to take dance as serious career choice like medicine and law'
From winning street dance championship for 1989 to becoming dance scholar, Dr Terry Ofosu dey advocate make pipo respect dance and take am seriously as career choice.
All you need sabi about 2026 UTME examination as Nigeria police update candidates on security
Dis slips contain candidates exam date, venue, and oda important details.
Pope say e 'no dey fear' Trump afta US president criticise am
Donald Trump accuse di pope say e dey "WEAK on Crime and terrible for Foreign Policy".
How Ghana footballer Dominic Frimpong die inside late night armed robbery attack on team bus
Di football community for Ghana dey mourn death of 20-year-old Berekum Chelsea striker Dominic Frimpong wey die afta armed robbers attack dia team bus for night afta league game.
Di Ghana prophet and di mysterious death of im wife Charmain Speirs
One BBC Disclosure investigation don expose significant questions about wetin happun for di hotel wia Charmain die.
Women no suppose give birth wen dem lie down wit dia back
E dey more dangerous for women to give birth wen dem dey lie down, So why dem dey do am? Na sake of one Frenchman wey decide say e dey more convenient – for men.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.















































