Suspected gunman for White House Correspondents dinner dey charged wit attempting to assassinate US President Donald Trump

Wia dis foto come from, @REALDONALD TRUMP / TRUTHSOCIAL
- Author, Jaroslav Lukiv
- Author, Emma Pengelly & Thomas Copeland
- Role, BBC Verify
- Read am in 6 mins
Authorities don charge one California man wit attempt to assassinate US President Donald Trump aftear e try to enta one gala event wey Trump dey attend, wit weapons on Saturday night.
31 year old Cole Tomas Allen also dey charged wit two firearms offences wen e appear for court for Washington DC on Monday.
E no enter any plea.
E bin dey carry semi-automatic handgun, pump-action shotgun and three knives as e charge past a security checkpoint for di White House Correspondents' Association dinner on Saturday, prosecutors tok.
Dis incident don cause make dem review di security of di White House.

A Secret Service agent bin dey shot but e no dey seriously wounded during di attack for one hotel.
Di accused go face life in prison if court find am guilty.
Dressed in a blue jumpsuit wit nametag, di suspect appear to dey calm during im appearance for court on Monday for Washington DC.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem tok to am softly as e answer almost evri question from di judge wit either "yes, your honour" or "no, your honour".
E state im age and say e get master's degree.
Three US marshals stand behind am, and one bin dey im side, while di federal prosecutor wey dey handle di case, US Attorney for Washington Jeanine Pirro, dey look on.
During di Saturday night incident, dem rush Trump, Vice-President JD Vance, cabinet members and oda White House officials from di Washington Hilton hotel ballroom after di gunfire ring out.
Di suspect allegedly rush through a security checkpoint one floor above di basement venue.
"One Secret Service officer bin dey shot in di chest, but e him dey wear a ballistic vest wey work," na so Acting Attorney General Todd Blanche tell a news conference on Monday.
"Dis heroic officer wey dem hit him fire five times at Allen, wey bin no dey shot but fall to di ground and dem promptly arrest am."
Blanche say di suspect dey believed to don discharge im shotgun at least once. E no dey clear weda di Secret Service agent bin dey shot by di suspect, or e dey in between di crossfire from oda law enforcement. Dem don release di agent from hospital.
Attempting to assassinate di president carry a potential life sentence.
Di oda charges - transportation of a firearm between states to commit a felony and discharging a firearm in a crime of violence - both get maximum sentences of 10 years. Di suspect go appear in court again on Thursday.
Di court hear say di accused crossed multiple state lines in order to try to kill Trump.
Di suspect comot form im house for di city of Torrance for di Los Angeles area on 21 April, and travell by train to Chicago, na so officials tok.
Citing dia sources, CBS also say at least five to eight gunshots dey fired during di incident.
CCTV footage wey Trump post show as one pesin rush past security officers, wey later turn and chase am.
For one earlier news conference, police tok say di security officials and di suspect exchange fire, but no tok how many shots dey fired.
Washington interim police Chief Jeffery Carroll tok say gunfire no touch di suspect but dem don carry am go hospital for evaluation.
Di suspect na guest for di Washington Hilton hotel wia di correspondents dinner bin dey hold, Carroll tok, and add say e dey "armed wit shotgun, one handgun, and multiple knives".
"At dis point, e be like say e be lone actor, a lone gunman," di police chief tok.
Trump later post one close-up photo wey show one man wey no wear shirt for ground, hand cuffs for im hand and Secret Service surround am.
On Sunday, Trump tell Fox News say di suspect "get plenty hatred for im heart for a while", and e add say im family know say e get "difficulties".
Di US president say di suspect get "manifesto" and suggest say e be "strongly anti-Christian".
US media dey report a history of anti-Trump social media posts from 31-year-old Allen, citing law enforcement sources.
BBC partner CBS News see one written document dem believe say dey connected to di suspect. Oda US media don also report on di same document.
Di document say di gunman wan target members of di Trump administration "from highest-ranking to lowest" and although guests and hotel staff no be di intended targets, dem go dey attacked if necessary to get to di officials.
BBC News neva independently verify di alleged writings, wey dey described as a manifesto and reports say dem send dem give di suspect family members bifor di attempted attack.

Wia dis foto come from, Reuters
Pictures later comot wey show as FBI agents and police dey search one area for one California address dem believe dey linked to di alleged gunman.
BBC Verify don dey look into di online presence of di suspect.
Los Angeles County voter registration records appear to show say e no register any party preference.
According to one Federal Election Commission record, wey BBC Verify see for October 2024, Allen donate $25 (£18) to di fundraising platform ActBlue wit di money wey dey earmarked for Kamala Harris presidential campaign.

Wia dis foto come from, LinkedIn / Cole Tomas Allen
Allen describe imsef as a mechanical engineer, game developer and teacher on LinkedIn.
According to im profile, e study mechanical engineering for di California Institute of Technology (Caltech) one highly competitive university, wia e take part for dia Christian fellowship.
E graduate wit masters for computer science for 2025 from California State University, Dominguez Hills. E mark di milestone by sharing one foto of imsef in graduation robes to LinkedIn. E also develop and release one game e call "Bohrdom" to di gaming platform Steam.
On Facebook, fotos of Allen - wey BBC Verify match to dos of im arrest for di Washington Hilton hotel - show am dey smile inside family photographs for Christmas and graduation events.
For December 2024, C2 Education name am teacher of di month. C2 education dey offer tutoring and college test preparation to students, according to di organisation Facebook post.
E don serve as part-time teacher there since 2020, im LinkedIn profile tok.
Jeanine Pirro, US attorney for Washington, say di suspect now dey face two charges - e use firearm during one crime of violence and assault on a federal officer using dangerous weapon.
She add say dem go formally charge am on Monday, 27 April for di federal court.
















