In fotos: Di looks wey steal di night for di AMVCA 2026
Read am in 4 mins
Di 2026 edition of di Africa Magic Viewers' Choice Awards on Saturday 9 May na anoda grand celebration of African film, fashion and storytelling, wey bring togeda di continent biggest stars for a night filled wit glamour, emotion and well-deserved recognition.
From ogbonge red carpet appearances to defining career moments on stage, di ceremony once again prove why di AMVCA remain one of di most prestigious platforms for African entertainment.
Linda Ejiofor double victory na one of di defining highlights of di night, and e further cement her place as one of Nollywood most versatile performers.
Uzor Arukwe win di Best Lead Actor for Colours of Fire, while Bucci Franklin win di Best Supporting Actor for To Kill a Monkey.
For Uzor Arukwe, di lead actor win mark anoda major milestone for im career wey don continue to gain momentum in recent years.
Wetin we call dis foto, Osas Ighodaro come prepared for di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Queen Mercy Atang dress still dey make pipo tok
Wetin we call dis foto, Nana Akua Addo come 'cathedralled'
Wetin we call dis foto, Buchi Franklin win di Best Supporting Actor for di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, John Tyler Ekanem wear pink suit to di twelfth edition of AMVCA
Wia dis foto come from, AMVCA red carpet
Wetin we call dis foto, Simi Drey, wear this dress wey dem make from glass.
Wia dis foto come from, AMVCA red carpet
Wetin we call dis foto, Uche Jumbo grace the red carpet wit this beaded dress, wey dem style elegantly to fit her fashion taste and style.
Wetin we call dis foto, Sunshine Rosman wear this beautiful blue and black dress on di red carpet.
Wetin we call dis foto, Sunshine Rosman come prepared for di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Lateef Adedemije film Lisabi win di Best Indigenous Language Film (West Africa). Di same film also give am nomination for Best Lead Actor wey Uzor Arukwe win.Dem also nominate Lateef Adedimeji for Best Supporting Actor wey Bucci Franklin win
Wetin we call dis foto, Racheal Okonkwo wear beaded pink and blue dress to show dem say she come preapred for di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Uche Jumbo come prepared for di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Bisola Aiyeola bin dey nominated for Best Supporting Actress for Gingerrr, but na Linda Ejiofor win am for The Herd
Wetin we call dis foto, Kanayo O Kanayo win Industry Merit Award
Wetin we call dis foto, Uche Motana win di Trailblazer Award for di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Anita Natacha Akide grace di AMVCA 2026 wit sequin dress
Wetin we call dis foto, Oluwabukunmi Adeaga-Ilori, wey pipo sabi as Kiekie no carry last for her fashion style for di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Bolaji Ogunmola for AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Tobi Bakre bin win di Best Actor in a Drama, Movie, or TV Series for di 2023 AMVCA but e no get any nomination dis year.