South Africa say dem deport ova 53,000 foreigners for di anti-migration campaign

Police push back protesters in South Africa

Wia dis foto come from, RAJESH JANTILAL / AFP via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Di South African govment don reveal di number of foreign national wey dem deport comot from dia kontri since dem launch di anti-migration demonstrations.

South Africa say dem don send more dan 53,000 foreign nationals back either deported or repatriated since di campaign start five weeks ago.

Most of di deported nationals na from Malawi, Zimbabwe, and Mozambique, according to wetin officials say.

Dem say e possible make di number still rise as more repatriations and deportations kontinue.

On June 30, thousands of South Africans enta street to protest wetin dem call anti-immigration march against undocumented migrants.

Wen di protest end, di organisers say dem no go end dia as di protest go kontinue.

According to Jacinta Ngobese-Zuma, di leader of March and March movement, she say di protest against undocumented migrants for South Africa go continue until di govment introduce tougher laws against illegal migration.

She say March and March go dey protest evri Thursday for di next six months to force di govment to "get rid of" undocumented migrants wey still dey for South Africa.

Di protesters dey demand tighter border controls and mass deportations, as dem accuse migrants say dem dey contribute to high unemployment, rising crime rates and collapse of public services.

Several kontris, including Ghana, Nigeria, Uganda and Kenya, don repatriate plenti of dia citizens comot from South Africa.

Number of foreign nationals South Africa deport

South Africa Justice and Constitutional Development Minister Mmamoloko Kubayi announce on Sunday say dem don process 53,499 foreign nationals for deportation and repatriation.

DI minister add say di deported foreign nationals dey dominated by di 'Malawians, follow by Zimbabweans and Mozambicans'.

"We dey strive to achieve orderly and regular migration wey dey mindful and sensitive to di concerns raised by our pipo, while observing human rights and dignity of all pipo for our kontri, irrespective of dia citizenship and immigration status," Kubayi tell news conference for Pretoria.

South Africa Justice minister say di repatriation and deportation process don help dem catch pipo wey dey wanted by di police for alleged criminal activity.

Authorities say dem go kontinue dey enforce dia immigration laws, but warn say di protesters need to stop to conduct unauthorised search of homes and businesses wey dem suspect say dey house undocumented migrants.

Protesters marching, man for front dey point stick for di camera.

Wia dis foto come from, EMMANUEL CROSET / AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Protests hold across South Africa as thousands demand say all undocumented migrants comot di kontri

More dan three million documented foreign nationals dey for South Africa, according to official figures.

Di statistics no add di record of many more migrants dem believe say dey di kontri witout papers - wey be di bone of contention for di protesters.

Police tok say dem don arrest about 50,000 migrants since January ontop accuse say dem dey di kontri illegally.

Meanwhile, South Africa President Cyril Ramaphosa acknowledge public concerns about immigration but also condemn attacks against migrants, as e warn di citizens against taking law into dia own hands.

Di UN don warn against using migrants as scapegoats for South Africa socioeconomic challenges.

Dem say dem don begin investigate di validity of some identity documents wey make dem block di IDs.

South Africa say if dose wey dey affected by di blocked IDs no take action, e fit lead to "possible permanent cancellation".

According to di notice by di Home Affairs, dem wan find out through dia investigation if di pipo wey dem block dia IDs na di true owner of di documents.