Nollywood actor Lateef Adedimeji and wife Mo Bimpe welcome triplets five years after marriage

Adedimeji Lateef and im wife, Adebimpe Oyebade

Wia dis foto come from, @adedimejilateef/Instagram

Read am in 4 mins

Nollywood actor, Lateef Adedimeji, and im wife Adebimpe Oyebade, wey pipo sabi as Mo Bimpe don announce di birth of dia triplets, five years afta dem marry.

Di couple make di announcement about di birth of dia triplets on dia Instagram page on Friday.

Lateef and Mo Bimpe share dia happiest moment wit dia fans on Instagram, as dem explain di reason why dem keep quiet ontop social media na becos say dem dey "build, protect, and embrace" di greatest blessings of dia life.

Lateef describe di birth of di new born babies as "my world, my responsibility, and my legacy".

"I bin dey quiet… but I no dey absent. I bin dey build, dey protect, and dey embrace di biggest blessing for my life," Lateef tok dis on Friday.

"God give me pass wetin I pray for, woman wey don become mother of three, and three kings wey I fit call my own @etawithlove.

"My world. My responsibility. My legacy. Alhamdulilah!"

Di both of dem marry each oda for December 2021.

For 2025, inside one interview wit Chude Jideonwo, Lateef tok about im struggles in marriage and di tok-tok wey im and im wife dey face.

Di actor tok say im wife bin show am one message from troll on Instagram ontop her phone wia dem call her "barren"

"Me and my wife dey receive plenti trolling. Recently, one pesin call her barren on social media. She go always show am to me and say she go dey alright," Lateef tok.

"Wen time reach wetin go be, go be. Pipo no know wetin you dey go through, dem no know your decision. Dem no know you, weda you don marry, but you come tok say bae make we play for 14 years den afta make we born pikin."

Di actor tok say im ask im wife, Mo Bimpe make she ignore dem and ask her make say no dey feel any pressure from di rumour pipo dey carry.

For 2021, Mo Bimpe and Lateef tie di knot and finally open up about dia relationship, afta dem bin claim say dem just be friends.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Who be Lateef Adedimeji

Foto of Adedimeji Lateef

Wia dis foto come from, @adedimejilateef/Instagram

Lateef Adedimeji na Nollywood actor, screen writer and producer.

Dem born am for 1 February 1986 for Lagos state, but e come from Ogun State.

Lateef obtain im BSc degree from Olabisi Onabanjo University.

E begin dey act professionally for 2007 and don act plenty feems both English and Yoruba feems including Lisabi, Jagun Jagun, Ayinla, The Uprising, among odas.

E also don win plenty awards including di Best Actor in a leading role award for di 2025 Africa Movie Academy Awards (AMAA) for di movie Lisabi

Who be Adebimpe Oyebade

Foto of Mo Bimpe

Wia dis foto come from, @adedimejilateef/Instagram

Oyebade Adebimpe wey many pipo sabi as Mo Bimpe na Nigerian actress.

Dem born her March 23, 1997. She be native of Ijero for Ekiti state, South West Nigeria.

She start her acting career for 2016 and don feature for plenty Yoruba feems.