'I wan make am clear say I no dey resign' - South Africa President Ramaphosa react to court ruling

Wia dis foto come from, Reuters
President Cyril Ramaphosa don tok say im no get plan to resign and say im get plan to challenge di report of wetin dem find against am.
South Africa president tok follow di ruling by di Constitutional Court on Friday 8 May 2026, wey rule say di National Assembly bin act unlawfully wen dem vote for December 2022 to dismiss di Section 89 Independent Panel report wey concern President Cyril Ramaphosa Phala Phala scandal.
Di president for one short notice address to di nation on Monday say im don dey face calls to resign from im position sake of di ruling.
However, e say pipo don also tell am make e no resign.
E add say nothing say inside di ruling of di Constitutional Court wey tell am to resign.
"I wan make am clear say I no dey resign," e tok.
South African opposition leader Julius Malema don call on President Cyril Ramaphosa to resign.
Dis dey come afta di Constitutional Court rule say parliament violate di constitution as dem block moves to impeach am for 2022.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di judgement follow one legal challenge by Malema Economic Freedom Fighters (EFF) and odas, and e fit result in fresh impeachment proceedings.
In response to di ruling, President Ramaphosa office say e respect di judgement.
"To do so go be to abandon di responsibility wey I assume wen I become President of the Republic. To resign now go be to give in to dose wey dey seek to reverse di renewal of our society, di rebuilding of our institutions and di prosecution of corruption".
Di scandal titled "Farmgate" na major embarrassment for Mr Ramaphosa since e break for 2022, becos e come to power on promise to fight corruption and clean up di image of di govning African National Congress (ANC).
Earlier, di speaker of South Africa lower house of parliament, Thoko Didiza, say parliament go start di process to set up impeachment committee to further probe allegations against President Cyril Ramaphosa ova Phalaphala scandal.
Di ANC top officials dey locked in high-level meeting to map out dia next move. Di party executive committee dey expected to convene anoda emergency meeting on Tuesday as dem dey battle di political fallout.
E still get long way to go for di impeachment process. Vote of no confidence motion against Oga Ramaphosa wey go require simple majority to pass (50+1) also dey unlikely to succeed as di president go get di backing of most ANC MPs and coalition govment partners including di Democratic Alliance.
Di Farmgate scandal
Di Farmgate scandal start for June, wen one former South African spy boss, Arthur Fraser, file complaint wit police accusing di president of hiding di theft of $4m from im Phala Phala farm for di north-east of di kontri for 2020.
Oga Fraser, wey be loyalist of former President Jacob Zuma, allege say di money fit be some tin wey come out through money-laundering and corruption, and accuse di president of kidnapping and bribing di burglars.
To hold dat kain plenty money in dollars fit violate foreign exchange control laws.
Oga Ramaphosa don confam robbery, but say di amount dem tiff no reach wetin pipo dey tok – e also deny say im wan cover up di matter.
Some $580,000 wey buyers pay in cash for buffalo na im dem tiff under di sofa cushions for di farmhouse, e tok.













