Why South Africa President Cyril Ramaphosa dey face calls to resign

Wia dis foto come from, Getty Images
South African opposition leader Julius Malema don call on President Cyril Ramaphosa to resign.
Dis dey come afta di Constitutional Court rule say parliament violate di constitution as dem block moves to impeach am for 2022.
Di judgement follow one legal challenge by Malema Economic Freedom Fighters (EFF) and odas, and e fit result in fresh impeachment proceedings.
In response to di ruling, President Ramaphosa office say e respect di judgement.
Na for 2022 one independent panel tok say Ramaphosa fit get case to answer afta jaguda pipo tiff $580,000 (£430,000) in cash, wey bin dey inside chair for im house.
Di theft bin lead to allegations say e no declare wia di money bin come from.
Di president bin deny any wrongdoing.
Dem block impeachment proceedings four years ago for one parliamentary vote. At di time Ramaphosa African National Congress (ANC) bin get majority for parliament, but since di 2024 general election, di ANC ruling na by coalition.
Afta di judgement, Ramaphosa office say e "reaffirm im commitment to di Constitution, di independence of di Judiciary plus di rule of law".
Di statement say di president don dey "consistent in providing im full assistance" to all enquiries into di mata.
"President Ramaphosa maintain say nobody dey above di law and say any allegations suppose dey subjected to due process witout fear, favour or prejudice."

Wia dis foto come from, EPA
As e dey follow tori pipo tok outside di court for Johannesburg earlier, Malema say Ramaphosa suppose resign and "concentrate on dis impeachment process becos e get serious implications on am as individual".
"You no go fit serve di two - one go suffer," e explain, e dey refer to being a president and preparing for impeachment.
Di EFF bin carry di case go di kontri highest court alongside di African Transformation Movement for 2024.
Malema say members of Ramaphosa ANC go impeach am becos "di evidence go dey clear bifor dia eyes".
Geordin Hill-Lewis, leader of di Democratic Alliance, di second largest party for di governing coalition, tok say politicians gatz "uphold di rule of law", and e say parliament impeachment committee "must now do dia work properly, rationally, fairly and constitutionally".
Dis saga - wey local media nickname "Farmgate" bin start for 2020, afta jaguda pipo tiff $580,000 from Phala Phala, Ramaphosa farm for di northern Limpopo province.
Two years later, one independent panel bin find evidence say di president fit don violate im oath of office, but for inside one debate wey focus on dia conclusions, parliament bin vote 214 to 148 against to set up impeachment committee.
South Africa get strict rules on holding foreign currency. Di law say e must dey deposited wit authorised dealer like bank for 30 days.
At di time, Ramaphosa bin tok say di cash na from selling one buffalo.
Three people dey on trial for di theft.










