Ghana petition Africa Union to chook mouth for 'xenophobic attacks' against African migrants for South Africa

Ghana Foreign Affairs Minister Samuel Okudzeto Ablakwa

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Ghana wan make di Africa Union discuss di mata for dia mid-year coordination meeting for Egypt in June
Read am in 5 mins

Di govment of Ghana don take more action to try to raise di issue of attacks and harassment against African nationals for south Africa.

Days afta di kontri relocate one man inside viral video wey anti-migrant protesters bin dey harass for im shop for Diepkloof, near Soweto, Johannesburg.

Di govment don petition di Africa Union (AU) to chook mouth for di wave of attacks on foreigners wey dem describe as xenophobia.

Anti-illegal immigration protest groups and oda vigilante societies deny say wetin dey hapun now be xenophobia, but say dem dey campaign against undocumented foreigners who dey collect dia jobs.

Dem accuse local authorities of neglect as South African citizens continue dey struggle wit unemployment.

For Mthatha, Pretoria, Durban and Johannesburg, hundreds of young pipo bin dey protest for more than one week to demand action against di illegal migrants.

Some kontris don condemn attacks on Africans including Nigeria and Mozambique.

Di United Nations (UN) also chook mouth wey dem demand say make South Africa authorities deal wit di rising cases of attacks.

Young men dey protest for street

Wia dis foto come from, IHSAAN HAFFEJEE/ANADOLU VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, South Africa anti-illegal migration groups say foreigners bin take dia jobs

Di AU gatz discuss di mata for dia coordination meeting in June

Ghana Foreign Affairs Minister Samuel Okudzeto Ablakwa bin write to di AU say make dem include di mata of xenophobic attacks for South Africa inside dia agenda for di eight mid-year coordination meeting of di African Union wey go hapun from 24 – 27 June 2026.

Inside one statement, di minister say "di topic of xenophobic attacks for South Africa be mata of concern wey lead to loss of lives and properties in recent years."

Ghana govment say di development

  • Be clear violation of di African Charter on Human and Peoples' Rights wey South African don sign up to
  • E dey undermine di spirit of integration and Pan-Africanism
  • E dey against di objectives of di African Continental Free Trade Area (AfcFta) wey dey promote free movement, reduce barriers and foster common market wey go benefit all Africans.

Di kontri now ask di chairperson for di African Union commission say make im consider some measures for di proposed African Union tok-tok wey go hapun for di mid-year coordination meeting for El Alamein for Egypt.

  • Make dem carry di xenophobia attack mata put for di agenda wit di rules of procedure
  • Make di AU increase dia monitoring to support member states to respect dia obligations under di constitutive act of di AU and di Charter on Human and Peoples' Rights
  • Make dem create fact-finding mission to chook eye inside di mata wey dey cause di xenophobic violence for South Africa wey dem gatz recommend appropriate measures to di AU
  • Make dem begin dialogue and reconciliation wey go promote tolerance, inclusion, integration and unity among African pipo
Protesters dey march for streets

Wia dis foto come from, IHSAAN HAFFEJEE/ANADOLU VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Di anti-illegal migration protesters accuse foreigners of criminal activities for parts of di cities

Di foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa confam say Ghana bin dey ask dem to consider dis mata as serious tin wey dey affect relationships among members of kontris for Africa.

"Ghana believe say despite di painful legacy of slavery, colonialism and apartheid, di future of Africa be one wey gatz shared dignity, prosperity and mutual respect. We gatz ensure say no African dey dehumanized on top African soil."

Meanwhile Nigeria and Ghana begin steps to repatriate dia citizens for South Africa wey dey face threats and harassment back to dia kontris.

About 150 Nigerians for South Africa already don show interest to comot di kontri as anti-illegal migrant protests across cities for di kontri continue.

'African nationals still dey face harassment for South Africa'

South Africa don record several xenophobic attacks against foreigners wia angry youth bin loot and burn shops wey belong to African migrants for some cities.

For 2019, di attacks even lead to death of some African nationals, na so Zimbabwe, Mozambique, Rwanda, Zambia and Sierra Leone condemn di development wey dem describe am as 'barbaric' at dat time.

Till date, African nationals for di kontri still dey suffer attacks, harassment and bullying for public places, schools and even workplaces.

One Nigerian-South African man Peter Odike wey don dey live for South Africa for more dan 20 years tell BBC say im children dey face bully for school from locals.

"So, pipo dey fear, I get three kids, and dem dey bully dem for school. Na me dey even dey comfort dem."

Ghana officials dey airport to welcome back citizen wey face attack for South Africa.

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Ghana authorities relocate one man Emmanuel Asamoah wey face harassment for South Africa back to di kontri

Peter, wey don dey naturalised for South Africa since 2006, tok say many migrants including im family members dey fear for dia lives.

Di papa of three, wey marry South African woman, dey operate one small shop for Johannesburg, wia e dey sell shoes.

E say businesses owned by foreigners don dey close down sake of dis attacks.

Peter tok say even police dey harass migrants for South Africa evri day despite say dem get dia legal documents.

"Business dey go down, e no dey safe to stay here," Peter tok.

Peter add: "Police dey harass pipo evri day, even wen you get document na problem wit your face. Once you no look like South African na problem for you.

"Some pipo, even wen you show dem paper dem go ask you, 'Why you dey here?' You gatz go back.'"

South Africa govment say security agencies dey investigate di attacks but maintain say di kontri neva be xenophobic

South African govment initially condemn di attacks on African migrants inside viral videos.

Dem ask dia citizens say make dem no attack foreigners during dia protests but maintain say dia kontri no dey xenophobic.

Presidential spokesperson Vincent Magwenya say President Cyril Ramaphosa bin dey expect di law enforcement agencies to take action against violent protesters.

Oga Vincent Magwenya for one media briefing on Wednesday 6 May tok say di South African president bin discuss di mata wit Mozambique president Daniel Chapo when im visit South Africa.

"Both presidents bin gree say South Africans no be xenophobic, wetin dey happun na pockets of protest, wey dey legal according to our constitition."

"Di reality of immigration also bin dey, not only for South Africa but throughout di world. Wetin dey important na to respect di rights of everibodi wey dey within our borders wey di protesters gatz protest without harming anybodi," Vincent Magwenya explain.

Im also add say both presidents gree say "African kontris gatz work togeda to deal wit issues wey dey cause plenty migration across di continent."

"Issues of conflict, instability and for some areas, misgovernance wey dey cause pipo to migrate and seek refuge for different parts of di continent including South Africa.