'Nigerian students no fit go school, business pipo no fit open dia shops' - Wetin don happun since anti-foreigners protests start for South Africa

Woman hold South Africa flag wit oda women for di background
Read am in 6 mins

Di Nigerian govment don ask South African govment to protect Nigerians and oda black immigrants wey dey live for South Africa sake of di rise in xenophobic protests.

According to di Chairman of Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom), Abike Dabiri-Erewa, di tension for South Africa don dey get out of hand.

"While many expect say make di tensions go down following earlier engagements between both govments, di situation on di ground dey get worse", Abike tok.

Nidcom say di commission receive reports say "pupils wey be Nigerian dey fear to attend school, and genuine business owners dey fear to open dia shops sake of fear of targeted attacks, looting, and harassment".

All dis kasala begin afta viral videos capture wen groups of South Africans wey describe diasef as anti-immigration taskforce dey attack foreigners; harass some of dem and even assault odas.

Also, demonstrations for several cities wey include Cape Town, Durban and East London don turn violent, and reports of looting, property damage and injuries full ground.

For one video, about three men bin punch di face and head of one Ghanaian during di protest wen dem find say im be Ghanaian.

Later on, oda videos begin dey show wia di South Africans dey pursue oda non-South Africans say make dem no do business for dia kontri.

One woman wey be di leader of di group tok say, "We dey fix dis continent, dis tin wia you pipo go dey move from one kontri to di oda no go work anymore. We dey tired wit African migrants wey dey refuse to fix dia kontris."

Nigerian govment say dem don study di situation for South Africa and dem beg make South African govment do somtin quick.

Hundreds of anti-immigrant lobby group and civil society organisations enta di streets of Pretoria, one of di largest city wey be home to migrants for South Africa, to protest.

Di protest also hold from Cape Town to Durban and East London, wia dem march go di union buildings and di official seat of di govment to voice dia frustration ova illegal immigration.

Protesters say govment dey fail to prioritise di needs of South African citizens, dem accuse di govment of turning blind eye to growing concerns around crime and jobs.

Di demonstrators hold somtin wey be like sticks, wear March to March T-shirts and carry placards wey dem write "March and March until we win. If fighting for my kontri mean say I be xenophobic, den I dey proudly xenophobic".

Dem want make govment send di pipo wey dey di kontri illegally back home.

Businesses around di area bin close dia doors, as fear dey say di protest fit turn violent.

Di anti-migrant campaigners demonstration dey come afta series of xenophobic attacks on foreigners for di kontri.

Dis demonstration dey come afta one recent anti-foreigners attacks for di kontri wey lead to di death of some African nationals including two Nigerians.

Two Nigerians die for attacks as govment issue warning

Chairman of di Nigerian Union of South Africa Olaniyi Abodedele confam di death of two Nigerians to BBC News Pidgin wia e tok say dem die for di same week wey anti-foreignesr protests bin dey ginger.

E identify di pipo wey die as Kelvin Chidiebere Amaramuiro and Ekpenyong Andrew.

Wen e dey explain di circumstances wey surround di death of di two Nigerians Oga Abodedele say Andrew die on Sunday, 19 April for Pretoria West.

E say officials bin arrest am, and no tell am wetin be im offence. E claim say dem beat am to death and dump im bodi for hospital.

For di second victim, Abodedele say according to reports wey im gada, police and di military invade Kelvin Amaramuiro house on Monday, 20 April and ask am to provide evidence of wetin e dey do and dem beat am, lock am for jail and e later die afta dem release am on bail.

Security operatives for di kontri neva react to dis allegations, but more attacks dey hit South Africa as protests dey happun for di kontri.

"Nidcom appeal to di Govment of di Republic of South Africa make dem take urgent and visible steps to protect all foreign nationals within dia borders, as required under international law and African Union protocols on free movement and human rights."

Nigeria govment say make dem no profile any Nigerian or try to generalise sake of say crime no get kontri.

Dem say anybodi wey commit any crime, make dem investigate am so di pesin go face full penalty under di South African law.

"Nidcom therefore demand immediate security and increased police presence and patrols for flashpoint communities wia Nigerians dey reside and trade."

Ghana demand investigation, promise to help victim

One video capture wia about three men bin dey punch di face and head of one Ghanaian during di protest wen dem find say im be Ghanaian.

Sake of dat video, Ghanaian govment say make South Africa govment investigate di mata.

Foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa say im tok wit im counterpart for South Africa Ronald Lamola togeda wit dia minister for international relations about di latest incident.

Im describe di viral videos as "extremely disturbing".

Oga Ablakwa add say, "Di South Africa foreign minister don express sympathy wit di victims of di attack wey im promise investigation for dis mata."

Di Ghana foreign minister confam say di victim dey alright dey receive consular assistance.

"No Ghanaian die for dis latest attacks. We don dey ask our pipo to remain calm as we work to protect Ghanaians home and abroad."

On top social media, pipo bin dey ask Ghana authorities to act on di mata.

Later, Ghana promise say dem go help di victim relocate back to di kontri and add say dem go assist am.

Why South Africans dey protest against black immigrants

Dis anti-immigrant protests don cause major tok-tok for di kontri and also oda African kontris wia dia citizens dey chop attacks.

Di questions na why South Africans dey attack oda Africans wey dey dia kontri to do business.

South Africans want make govment send di pipo wey dey di kontri illegally back home.

Some of di protesters tell BBC say di protest na about illegal migration and joblessness for di kontri.

Dem say illegal migration na crime all ova di world and South Africa no be exception, as dem dey struggle wit scarce resources.

Anoda protester say di demonstration na to draw di ears of dia leaders as dem dey prioritise illegal migrants ova South Africans.

"If any foreigner feel say South Africans be xenophobic, make dem leave di kontri. You no fit stay for kontri wey no love you, you no fit dey kontri wey you no love, kontri wey you hate dia pipo... just comot di kontri, why you go wan stay for kontri wia you no dey comfortable about evritin wey dey happun for di kontri?"

South Africa govment condemn zenophobic attack

President Cyril Ramaphosa don condemn di recent xenophobic attacks, wey see some South Africans attack black Africans and destroy dia businesses for di kontri.

Di South African leader during di 2026 National Freedom Day celebration wey hold for Bloemfontein on Monday, 27 April, caution im kontri pipo say make dem no allow dia legitimate concerns about illegal migration lead to hatreds towards fellow Africans.

E say although South Africans dey concerned about undocumented and illegal migrants for di kontri, make dem however, no allow dis concerns lead to xenophobia.

"Make we no allow dis concerns give rise to xenophobia, directed towards pipo from oda African kontris or any oda parts of di world.

"We as South Africans no fit allow hatred towards odas drive us, odas give us compassion, dem give us support, we no fit dey driven by hatred towards dem", President Ramaphosa add.