You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
EFCC find yahoo boys enta club
Published
Read am in 1 mins
Nigeria corruption police - Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) say dem don arrest 12 pipo wey dem suspect say dey do yahoo-yahoo for Lagos state.
Dem arrest di suspects afta dem raid Club 57, one club for di Ikoyi area of di state.
EFCC say di suspects abandon dia fine-fine cars run, but same dem seize 10 cars for di operation.