Obasa, Buhari, Elumelu, Amaewhule - di big winners and losers for di APC primaries for House of Reps aspirants

Wia dis foto come from, Mudashiru Obasa/Yusuf Buhari/ Martins Amaekwule/Facebook
Nigeria ruling All Progressives Congress (APC) on Saturday 16 May, hold dia primary elections for aspirants wey wan contest for di House of Representatives, and di exercise across di various states for di kontri throw up ogbonge surprises.
One of di big ones na how popular show biz personality, Paschal Okechukwu wey pipo know as Cubana Chief Priest, lose im own primary election wey pipo tink say e go win sake of im social media popularity.
However, as di results of di primaries dey come out, e dey clear say surprises still plenti as many sitting House of Reps members lose dia tickets.
Here na list of some of di big losers and also di winners for di APC House of Reps primary elections:
Di big winners

Wia dis foto come from, Ndudi Elumelu/Facebook
Mudashiru Obasa: Di Lagos State House of Assembly Speaker for more dan ten years decide to step up to di federal level and e win im ticket easily.
Obasa comot di incumbent member Hameed Adewale to collect di Agege federal constituency ticket.
Also, di current chairman of Kosofe Local Govment Area for Lagos State, Moyosore Oshinowo, defeat di sitting rep for di area Kafilat Ogbara to collect di Kosofe federal constituency ticket.
Yusuf Buhari: Di son of former president Muhammadu Buhari also decide to step into di political arena wit im full chest, riding on di overwhelming goodwill of im papa.
E easily win di ticket to run for di Sandamu/Daura/Mai'adua federal constituency seat for Katsina State, defeating Auwal Daura, who im papa na di former director general of di Department of State Services (DSS).
Di young Buhari defeat im opponent by more dan 6,000 votes as e gada a total of 6,386 votes while di young Daura get only 322 votes.
Ndudi Elumelu: E bin fall victim to di Peter Obi political tsunami for di 2023 general elections, wia plenti new names wey contest using di Labour Party bin win dia elections, sake of di massive grassroots support wey di party presidential candidate Peter Obi bin dey enjoy.
Elumelu bin first enta di House of Reps for 2007 to represent di Aniocha/Oshimili federal constituency of Delta State, and e also win re-election for 2011. But e leave di legislature to run for di seat of di Delta State govnor for 2015 and e lose.
For 2019, Elumelu return to di House bifor di Obi wave sweep am comot for 2023. Now, e dey plan to return again for 2027 and sabi pipo say di odds dey favour am.
Martin Amaewhule: Na di current Speaker of di Rivers State House of Assembly, and a loyal godson of di state former govnor and current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike.
Amaewhule and Wike also come from di same federal constituency Obio/Akpor, wia di Speaker don win di APC ticket to contest for di 2027 general election.
Di big losers

Wia dis foto come from, Julius Ihonvbere/Facebook
Paschal Okechukwu - Cubana Chief Priest: Even bifor e pick form to contest for di ticket of di Orsu/Orlu/Oru East Federal Constituency seat for Imo State, Chief Priest bin don trend plenty times on social media sake of im involvement wit di 'City Boys Movement'.
Di City Boys na political group wey Seyi Tinubu - son of President Bola Tinubu - bin form to campaign for im papa re-election, and Chief Priest na one of dia major members for di southeast.
However, dis fraternity wit di top echelon of power for Nigeria no translate to political success for Okechukwu who tori be say e score just 14 votes.
E later explain say e bin withdraw from di race afta APC stakeholders maintain say e neva reach di turn of im Local Govment Area, but e also tok say e regret trusting di elders of di community.
Julius Ihonvbere - current House Majority Leader: Dis na anoda big loss for di APC primaries, as Prof Ihonvbere wey be di current majority leader for di House of Reps, lose im return ticket.
According to tori by local media, Ihonvbere lose di Owan Federal Constituency ticket to Andrew Ijegbai wey be former Commissioner for Mining for Edo State.
But e don reject di result as e tok say di pipo wey suppose conduct di election no even come to di venue but dem just write result and force di returning officer to announce am.
"I be party man, so I go appeal dis result," oga Ihonvbere tok.
Esosa Iyawe - former Labour Party member: Oga Iyawe, wey be sitting House of Reps member lose im ticket to Paddy Iyamu who be former commissioner for Education for Edo State.
But some pipo don describe im situation as karma, bicos e bin win di 2023 election on di platform of Labour Party but e later decamp to APC.
Im too criticise di election process as e tok say e no follow democratic standards and e also claim say dem bin beat up some of im supporters and dem no allow dem vote.
Tijani Kayode - zero votes: Di member wey dey represent Ifelodun/Offa/Oyun Federal Constituency of Kwara State, no believe im ears afta dem announce say e get zero votes for di primary election.
E lose to Rafiu Ajakaye who tori be say e get di blessing of di state govnor, but e don reject di result and tok say di mata fit end for litigation.
Isiaka Ibrahim - Deputy Chief Whip: Oga Isiaka dey represent Ifo/Ewekoro Federal Constituency of Ogun State, and e bin dey contest for im fourth term as member of di House of Reps, but e lose di ticket sake of di consensus arrangement wey di state govnor approve.
Di pesin wey win am na di Ogun State commissioner for Women Affairs, Motunrayo Adeleye, who bin resign to run for di ticket wit di blessing of Govnor Dapo Abiodun.
Oga Isiaka blame di govnor for im loss as e insist. say e no lose di primary bicos dem no hold any primary, rather na voice affirmation dem do.
Isiaka Ibrahim: E bin just one out of five sitting members of di House of Reps from Ogun State wey lose dia tickets for di primary election.
Di odas na: Adesola Elegbeji of Remo federal constituency; Tunji Akinosi of Ado-Odo/Ota federal constituency; Abiodun Akinlade wey dey run for im fifth term as di rep for Ipokia/Yewa South federal constituency; and Femi Ogunbanwo of Odogbolu/Ijebu Ode/Ijebu North East federal constituency.
Anoda four chop loss for Imo State: Similarly, four sitting members of di House of Reps for Imo State lose dia tickets to return.
One of dem na Miriam Onuoha wey dey represent Okigwe South federal constituency. But she tok say she accept di result and go still dey loyal to di state. govnor, Hope Uzodinma.
Di odas na Harrison Nwadike of Isu/Njaba/Nkwerre/Nwangele federal constituency; Matthew Nwogu of Aboh Mbaise/Ngor Okpala federal constituency and Emeka Chinedu of Ahiazu/Ezinihitte federal constituency.










