US and Nigerian announce killing of ISIS second in command for joint operation

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
American and Nigerian forces don kill di "second in command of ISIS for di word" for one military operation, US President Donald Trump tok.
Trump tok dis one for one post wey e make ontop im Truth Social.
"Tonight, at my direction, brave American forces and di Armed Forces of Nigeria flawlessly execute a well-planned and very complex mission to kill di most active terrorist in di world from di battlefield," Trump write for im Truth Social post on Friday night.
"Our determined Nigerian Armed Forces, wey work closely with di Armed Forces of di United States, conduct daring joint operation wey deal heavy blow to di ranks of di Islamic State," Tinubu tok for statement.
E add say early intelligence reports confam di killing of "di wanted IS senior leader, Abu-Bilal Al-Manuki, also known as Abu-Mainok", along wit plenty of im fighters for strike wey target Abu-Mainok compound for Lake Chad Basin.
Di Nigerian military say "precision operation" happun sake of di "US - Nigeria partnership and intelligence sharing efforts wey dem just form".
"Togeda, we don disrupt a violent terrorist network wey endanger Nigeria and di broader West African region," Samali Uba, Nigeria military tok-tok pesin tok.
For 2023 Washington bin declare Al‑Minuki as a Specially Designated Global Terrorist.
Di death of di ISIS oga fit affect di operations of di Islamic State group (IS) since di killing of dia leader Abu Bakr al‑Baghdadi for 2019.
Al-Minuki, wey im name na also Abu Bakr ibn Muhammad ibn Ali al‑Mainuki, dey direct IS‑linked cells across Africa, particularly di Islamic State West Africa Province, wey don dominate di Lake Chad Basin and Sahel, wit cross‑border links into Niger, Chad, and Mali.
Trump post no provide further details of di operation or di timeline of di joint mission.
But di US President describe im death as a major blow to IS African and global networks, wey go affect funding channels and command structures.
Di US president thank di Nigerian govment for dia "partnership", adding say Minuki "no go terrorize di pipo of Africa or help dem to plan operations to target Americans again".
Nigeria and the US don increase dia military cooperation as di kontri kontinu dia effort to fight extremist violence.
For April, IS claim responsibility afta gunmen kill at least 29 pipo for one football pitch for Nigeria north-eastern Adamawa state.
Last Christmas, US and Nigeria carry out a joint airstrike for Nigeria Sokoto state wey target IS-linked groups.
Abu-Bilal Al-Manuki death: How e happun
More details don emerge on how di operation wey lead to di death of Al-Minuki take happun.
Nigeria Defence Headquarter for statement confam am again say Abu-Bilal Al-Minuki don die.
"Abu-Bilal Al-Minuki dey neutralised alongside several of im lieutenants and multiple combatants," di military confam for statement wey di di Media Information Officer, Hadin Kai Lieutenant Colonel Sani Uba issue.
On how di operation take happun, Oga Uba explain say na on Saturday, 16 May, at exactly 0001 hours di operation take start and e end at about 0400 hours. Dis na afta months of intelligence gathering, surveillance and reconnaissance.
Na joint counter-terrorism operation, wey include troops of di Joint Task Force (North East) Operation HADIN KAI (OPHK), plus close coordination wit di United States Africa Command (AFRICOM), carry out di operation wey lead to di neutralisation of Abu-Bilal Al-Minuki, di Islamic State (ISIS) second-in-command globally and di most senior ISWAP commander wey dey operate for di Lake Chad Basin and Sahel region alongside several of im key lieutenants and multiple combatants, di statement read.
Di US partners plus OPHK bin carry out precision air - grounds operations afta dem confam di location of Al-Minuki.
"Intelligence report bin confam say Al-Minuki plus im international terrorist cell get one well-hidden and fortified enclave for Metele, Borno State within Sector 3 OPHK."
Di military add say dem deploy special Forces wey provide security and block escape routes plus remove any of di teams or air platforms wey face wahala.
"Di operation involve several air platforms for synchronised air-land configuration wey leave di terrorists wit no avenue of escape," di statement read.
Di military also explain say dem receive authorization from di "High Military Command" bifor dem carry out di operation.
Di operation record zero casualties and no loss of assets, di military tok.
"Di operation dey executed wit zero casualties or loss of assets, wey be testament to di exceptional planning, superior tactical execution and di deepening synergy between Nigerian and US military forces for di global fight against terrorism."
However, dem explain say "Battle Damage Assessment" dey go on, and troops currently dey conduct aggressive follow-on exploitation operations to destroy identified splinter cells and prevent any attempt at reconstitution.
Who be Abu-Bilal Al-Manuki
Tori be say im real name na Abu Bakr ibn Muhammad ibn Ali al‑Mainuki but im get plenty oda names wey pipo take sabi am.
Dem born am for 1982 for Mainok, Benisheikh of Borno State Nigeria.
Sabi pipo say im nickname 'Mainuki' be like sometin wey come from Mainok, one town for Borno state sake of common regional tradition wia dem dey sabi pipo wit dia hometowns or family names.
According to di Nigerian military, Abu-Bilal al-Minuki play major role to coordinate IS operations beyond Nigeria, including media activities, weapons production, explosives and drone development.
Intelligence suggest say e be like say dem recently promote am to "Head of di General Directorate of States", to make am one of di most senior figures within di global IS positions plus one of di world most active terrorists.
Before dat time, officials say na im oversee US-linked operations across di Sahel and West Africa, including attacks wey target civilians and small communities.
Di military also link am to di 2018 Dapchi schoolgirls kidnapping - di kidnap of more dan 100 girls from one boarding school for north-eastern Nigeria.
Nigeria military tok-tok pesin Samali Uba ass say Abu-Bilal Al-Manuki bin also help move fighters to Libya in support of IS operations in North Africa.
Before Al-Manuki pledge allegiance to IS in 2015, dem bin describe am as a senior Boko Haram commander.
Di Lake Chad Basin wey border Nigeria, Chad, Niger and Cameroon - na major centre of Islamist insurgency for more dan a decade.
Di region na home to Boko Haram and Islamic State West Africa Province, or Iswap, wey dey regularly attack civilians, villages and military targets.
Di conflict for di region also dey closely linked to di wider crisis for di Sahel, wia groups wey dey linked to Islamic State and al-Qaeda don expand across Mali, Burkina Faso and Niger in recent years, for di middle of ongoing instability and weak state control for parts of di region.
Security analysts tok say na weak border control, political instability and poverty help militant groups to fit operate across di region.









