Explosions injure 18 for Damascus during Macron visit, French president dey 'safe'

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Hugo Bachega,Middle East correspondent and Adam Goldsmith
- Published
- Read am in 3 mins
Several pipo dey injured afta explosion wey happun for central Damascus, reportedly near di hotel wia French President Emmanuel Macron dey stay.
One security source tell di BBC say na explosive devices cause di blast.
Media for Syria say 18 pipo, wey include four police officers, wound.
Macron dey di capital for tok-tok wit im Syrian counterpart Ahmed al-Sharaa for di presidential palace.
Im officials tok say im dey safe wey im no hear di explosions.
After travelling to Syria, Macron dey set to visit Turkey for di Nato summit.
Di visit dey "kontinu as planned", according to di Elysee Palace.
Afta reports of di explosion for di city, videos and images on top social media dey show smoke and flames wey dey rise from one car near hotel for di Syria capital.
As dis report comot, Syrian state television tok say al-Sharaa don welcomed Macron to di presidential palace.

Wia dis foto come from, Reuters
BBC Verify dey analyse video footage of di blasts, wey show di explosions happun approximately 125m from di Four Seasons hotel, wey dey di pavement for Shoukry al-Quowatly, one major thoroughfare running thru di capital.
Afta im arrive for Syria on Monday evening, Macron become di first EU leader to visit di kontri since di fall of Bashar al-Assad's 24-year rule.
For di start of July, one bomb blast for one crowded café for central Damascus kill at least nine pipo wey injure 22 odas, according to Syrian state media.
Additional reporting by Richard Irvine-Brown









