Burkina Faso cut diplomatic relations wit France

Wia dis foto come from, Stanislav Krasilnikov / RIA Novosti/Anadolu via Getty Images
Burkina Faso don announce di cut of diplomatic relations wit France.
Dem make dis announcement inside one official statement wey dem publish on Friday, 26 June.
According to govment tok-tok pesin Comrade Pingdwendé Gilbert Ouédraogo, di move follow "thorough assessment" of bilateral relations.
Burkinabe authorities believe say di conditions for mutual respect and national sovereignty no longer dey, as dem denounce Paris "ceaseless activism" against national interests as well as dia "neocolonial ambitions."
Di statement condemn alleged support for "subversive networks and intent to marginalise di kontri on di international stage".
Burkina Faso bin gain independence from France on 5 August, 1960.
Since di military govment of Captain Ibrahim Traoré take power for September 2022, dem don accuse France say dem get "secret agenda".
French President Emmanuel Macron bin deny dis but insist say some African leaders show "ingratitude" for di deployment of im nation troops for di Sahel region in battling Islamist extremism.
For January 2025, Burkina Faso, along wit two oda military-led states - Mali and Niger, bin officially break away from di regional West African bloc, Economic Community of West Africa States (Ecowas) to form new alliance, di Alliance of di Sahel States.
Since Captain Ibrahim Traoré seize power, di kontri don deliberately move away from im former colonial power and seek new political, military and economic partnerships.
Although Burkina Faso bin gain independence from France for 1960, France bin remain major political and military partner for decades. French troops bin operate for di kontri as part of regional counterterrorism efforts against Islamist insurgencies linked to groups such as Al-Qaeda and Islamic State.
Wetin don happun since Traore seize power?
- Burkina Faso bin order French special forces to leave di kontri for 2023.
- Military cooperation agreements wit France bin dey terminated.
- French ambassador chop expulsion.
- Di govment portray France as kontri wey dia influence don fail to improve security or respect Burkina Faso sovereignty.
Traore don frequently argue say African kontris gatz control dia own resources instead of depending on Western powers.
Im speeches dey always invoke di legacy of Thomas Sankara, di revolutionary leader wey rename di kontri to Burkina Faso and champion self-reliance bifor dem kpai am.
For April dis year, Traoré bin suggest say most Africans no want democracy system and say Burkina Faso get dia own alternative approach, but e no give details.
Democracy "dey kill" and di pipo of Burkina Faso gatz "forget" am, di kontri military ruler tok for one interview wey air on state television.
Traoré bin initially promise to restore democratic rule to di West African kontri by July 2024, but two months bifor di deadline, di junta announce say im go extend im rule for anoda five years.
For January, e ban all political parties as part of one plan to "rebuild di state".
"Pipo need to forget about di issue of democracy. Democracy no be for us.
"Look Libya, dat na example wey dey close to us," Traoré tok.










