Nigeria summon South Africa Acting High Commissioner sake of xenophobic attacks

Nigeria and South Africa flags

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Nigeria don summon South Africa Acting High Commissioner sake of recent xenophobic attacks for di Southern African nation.

For one statement wey di Foreign Ministry tok-tok pesin Kimiebi Ebienfa release on Saturday, 2 May, di govment say dem go formally convey dia concern for one meeting on Monday, ova di incidents for South Africa wey fit affect existing relations between both kontris.

"Discussions go primarily focus on di ongoing demonstrations by various groups within South Africa and di documented instances of mistreatment of Nigerian citizens and attacks on dia businesses," di statement tok.

At least two Nigerians don die so far becos of di crackdown on dose wey dem consider illegal immigrants for South Africa. Many also dey face threats for several parts of di kontri, and dis don raise concerns about di safety of foreigners, especially business owners.

Nationals from oda African kontris such as Ghana and Ethiopia don also express discomfort wit di ongoing situation. Di Ghanaian govment bin previously announce plans to relocate Ghanaian citizen wey bin dey confronted by a group of angry South Africans, wey ask am to "go fix" im kontri.

Ghana later summon South Africa top envoy ova such cases of harassment and intimidation against dia citizens and oda African migrants.

Meanwhile, Nigerian authorities dey call for calm, as dem say dem dey committed to protect di rights and well-being of citizens wey dey live for South Africa.

South African President Cyril Ramaphosa bin condemn di xenophobic attacks but also caution foreigners to respect local laws.

Two Nigerians die for attacks as govment issue warning

Chairman of di Nigerian Union of South Africa Olaniyi Abodedele confam di death of two Nigerians to BBC News Pidgin wia e tok say dem die for di same week wey anti-foreigners protests bin dey ginger.

E identify di pipo wey die as Kelvin Chidiebere Amaramuiro and Ekpenyong Andrew.

Wen e dey explain di circumstances wey surround di death of di two Nigerians, Oga Abodedele say Andrew die on Sunday, 19 April for Pretoria West.

E say officials bin arrest am, and no tell am wetin be im offence. E claim say dem beat am to death and dump im bodi for hospital.

For di second victim, Abodedele say according to reports wey im gada, police and di military invade Kelvin Amaramuiro house on Monday, 20 April, and ask am to provide evidence of wetin e dey do and dem beat am, lock am for jail and e later die afta dem release am on bail.

Security operatives for di kontri neva react to dis allegations, but more attacks dey happun for South Africa as protests dey shele for di kontri.

"Nidcom appeal to di Govment of di Republic of South Africa make dem take urgent and visible steps to protect all foreign nationals within dia borders, as required under international law and African Union protocols on free movement and human rights," di Chairman of Nigerians in Diaspora Commission Abike Dabiri-Erewa tok.

Nigeria govment say make dem no profile any Nigerian or try to generalise sake of say crime no get kontri.

Dem say anybodi wey commit any crime, make dem investigate am so di pesin go face full penalty under di South African law.

"Nidcom therefore demand immediate security and increased police presence and patrols for flashpoint communities wia Nigerians dey reside and trade."

Why South Africans dey protest against black immigrants

Dis anti-immigrant protests don cause major tok-tok for di kontri and also oda African kontris wia dia citizens dey chop attacks.

Di questions na why South Africans dey attack oda Africans wey dey dia kontri to do business?

South Africans want make govment send di pipo wey dey di kontri illegally back home.

Some of di protesters tell BBC say di protest na about illegal migration and joblessness for di kontri.

Dem say illegal migration na crime all ova di world and add say South Africa no be exception, as dem dey struggle wit scarce resources.

Anoda protester say di demonstration na to draw di ears of dia leaders as dem dey prioritise illegal migrants ova South Africans.

"If any foreigner feel say South Africans be xenophobic, make dem leave di kontri. You no fit stay for kontri wey no love you, you no fit dey kontri wey you no love, kontri wey you hate dia pipo... just comot di kontri, why you go wan stay for kontri wia you no dey comfortable about evritin wey dey happun for di kontri?"