NDC confam Peter Obi as presidential candidate, invite Kwankwaso to face Tinubu, Atiku for 2027 election

Wia dis foto come from, NDC/X
Di Nigeria Democratic Congress (NDC) don announce Peter Obi as dia presidential candidate for di 2027 election.
Dem officially announce di former Anambra State govnor Obi as di party main flag bearer - since im be di only one wey pick nomination form for di president seat.
Di Independent National Electoral Commission (Inec) set 30 May as deadline for parties to submit di names of dia candidates wey go contest di 2027 general election.
NDC announce early Saturday morning say di special convention go hold for Abuja on 30 May 2026, wia dem go affirm dia presidential candidate.
Across di kontri, di NDC dey continue wit di primary elections for di oda aspirants wey dey run for different positions, from House of Representatives to Senatorial and govenorship seats.
"E don done.P.O clinch NDC presidential ticket," NDC write for dia page.
During di special convention wia dem confam Obi as di flagbearer, different supporters dey chant im name and also di name of Kwankwaso.
Obi say e accept di affirmation of di party, and e also invite Kwankwaso to join am.
"I graciously accept di affirmation as di candidate of dis great party, and in same spirit invite Dr Rabiu Kwankwaso. I assure you, abeg join us to build new Nigeria.
According to Seriake Dickson wey be national leader of di party, e confam di announcement of Obi and Kwankwaso as di presidential candidate and running mate ahead of 2027 election.
"I congratulate both His Excellency Peter Obi and His Excellency Senator Rabiu Musa Kwankwaso on dis historic milestone and assure dem of di full support of di leadership, members, and stakeholders of our party as we work collectively towards a successful campaign and victory at di polls," Dickson tok.

Wia dis foto come from, NigeriaNDCHQ/X
Peter Obi go face Bola Tinubu of All Progressives Congress (APC) and Abubakar Atiku of Africa Democratic Congress (ADC).
For di ruling APC, President Bola Ahmed Tinubu emerge di candidate with almost 11 million votes.
For ADC wey be di main opposition join-bodi movement for Nigeria, former Vice President Atiku win di presidential primary election.
Atiku get a total of 1,846,370 votes, to defeat im rivals, former Rivers State govnor Rotimi Amaechi (504,117) and businessman Mohammed Hayatudeen (177,120).
For di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi go come out as dia presidential candidate.
Obi bin don already promise say e go do only one tenure if e win, so dat di normal convention of rotating di presidency betwin di north and south go continue.
For Peoples Democratic Party (PDP) wey big internal crisis still dey go on, e neva clear who dia real presidential candidate be.
Di PDP still dey divided into two factions, and di two groups don nominate presidential candidate each.
On Tuesday, 26 May 2027, di PDP faction wey di current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, dey support, nominate one former Senator, Sandy Onor, as dia consensus presidential candidate.
For di event for di PDP national secretariat for Abuja, chairman of dia screening committee, Samuel Ortom, tok say Onor na di outstanding candidate wey dem sure say e go take di party to victory.
Anoda faction of di PDP dey gada too to confam former president Goodluck Jonathan as presidential candidate.
Who be Peter Obi

Wia dis foto come from, Peter Obi/X
Peter Obi na former govnor of Anambra state for southeastern Nigeria wia im get strong record. E also get active support base for social media.
Im become flagbearer wen Labour Party hold dia convention for Asaba Delta state for di 2023 election wit im vice Yusuf Baba-Ahmed, a former Senator from Kaduna state.
E dey portray im sef as 'Mr Clean' - some tin wey many Nigerian politicians no fit boast about.
Former aspirant himself Professor Pat Utomi step down for Obi wia e also tok say Obi deserve to get chance to govern Nigeria.
Dis na di third time wey di two term govnor go dey ontop presidential ticket as e serve as running mate to Atiku Abubakar of di PDP for 2019 elections, and presidential candidate for 2023.
Obi first comot labour Party to join ADC, bifor e later come go NDC.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post










