Robert Mugabe son to dey deported to Zimbabwe afta e plead guilty to firearm offences

Bellarmine Chatunga Mugabe (son of former Zimbabwean President Robert Mugabe) for Alexandra Magistrate Court on March 11, 2026 for Johannesburg, South Africa.

Wia dis foto come from, (Photo by Fani Mahuntsi/Gallo Images via Getty Images)

Wetin we call dis foto, Bellarmine Chatunga Mugabe (son of former Zimbabwean President Robert Mugabe)
Read am in 3 mins

Court for Johannesburg, South Africa don give order make dem deport di youngest son of di late former leader of Zimbabwe, Robert Mugabe sharp-sharp.

Bellarmine Mugabe plead guilty say e point firearm and im dey stay for di kontri illegally.

Dis dey come afta dem arrest am earlier dis month, afta di shooting of one 23-year-old man for dia house.

Court also order Bellarmine wey dey 28 years to pay fine of $36,000 (£26,700).

Di pesin wey dem accuse wit am Tobias Matonhodze - wey plead guilty to attempted murder, illegal immigration, possession of ammunition and defeating di ends of justice chop - three years jail sentence.

Authorities bin arrest two of dem on 19 February, wen police bin get call to come Mugabe house for di upmarket Johannesburg suburb of Hyde Park.

Dem bin carry one man wey dem believe say na security guard go hospital and im bin dey in critical condition afta dem bin shoot am.

Prosecutors bin tell di court say di shooting hapun afta kasala burst between di three men inside di property, and say dem bin shoot di victim two times for im back for outside wen im bin dey try to run.

Di authorities neva find di gun yet.

Since dat time, dem bin dey for police custody and dem plead guilty as part of ​negotiations wit prosecutors.

E no dey clear how Bellarmine Mugabe break South ​Africa immigration laws but im also plead guilty say im point toy gun for separate incident wey different from di one wey dem bin shoot one gardener.

Dem bin also charge Mugabe wit attempted murder bifor, but afta Matonhodze plead guilty, dem drop di charge against am.

Di charge wey dem sama am say e point gun na anoda separate case, wey no relate wit dis one but im agree make dem hear di two cases togeda, na wetin di National Prosecuting Authority (NPA) bin tell di BBC earlier dis month.

Mugabe bin don get multiple brushes wit di law.

For 2024, dem bin arrest am for allegedly assaulting one police officer for di Zimbabwean border town of Beitbridge.

Dem bin grant am bail but dem later issue warrant for im arrest afta im no show face for court, na wetin Zimbabwe state-run Herald newspaper bin report dat time.

Di following year, dem bin arrest am sake of say e bin assault one security guard for one mining site for Mazowe, wey be one hour drive north of di capital, Harare. Di case still dey on.

Bellarmine Mugabe na one of di two sons of Robert Mugabe wey im born wit im second wife, Grace.

Di former president, wey die for 2019, bin dey power for 37 years bifor dem remove am by force for one 2017 coup.