Wat next afta Ghana destroy ova 2,000 firearms?

Ghana looks to rid its cities of illegal weapons

Wia dis foto come from, GHANA SMALL ARMS COMMISSION

Wetin we call dis foto, Dem carry mechanical cutting machine to destroy di guns and oda weapons
Published
Read am in 4 mins

Ghana authorities don destroy ova 2,000 firearms and oda ammunition for dia national arms destruction exercise

Dis include pistols, locally manufactured AK47 rifles, shotguns and odas wey pipo bin surrender thru di kontri gun amnesty project and odas wey security agencies bin seize.

Di destruction be part of effort to reduce illicit arms wey bin dey circulate.

Di small arms commission say dem decide to first 'disable' di firearms permanently bifor dem go recycle dem sustainably.

Interior minister Muntaka Mubarak say every firearm wey dem destroy dey represent one less weapon available to criminals.

"Although Ghana be one of Africa most peaceful kontris, di proliferation of illicit arms and light weapons across di subregion dey continue to fuel armed conflict, organised crime, violent extremism and cross-border criminal activities."

Oga for di Small arms commission Dr Adam Bonaa say "dis exercise be important step to reduce gun violence and strengthen public safety."

As at September 2025, 2.3 million weapons dey di hands of civilians according to data from di small arms commission.

Out of dis number, pipo dey keep about 1.1 million illegally or dem no register dem.

Only 1.2 million of dis weapons dey registered legally wit di Ghana police.

As of 2025 2.3 million weapons were in the hands of civilians according to small arms commission data

Wia dis foto come from, GHANA SMALL ARMS COMMISSION

Wetin we call dis foto, Authorities say dem retrieve ova 4,000 firearms during di eight-week gun amnesty period between December and January

Authorities seize ova 4,000 firearms for dia eight-week gun amnesty programme

Ghana authorities say pipo surrender more dan 4,000 unlicenced firearms during dia eight-week amnesty period between December 2025 and January 2026.

Di gun amnesty programme encourage pipo and groups to surrender dia illegal weapons without facing prosecution.

Interior minister Muntaka Mubarak say "di gun amnesty programme dey successful, pipo surrender total of 4,038 unregistered firearms to di Ghana police."

Afta di eight-week period wey end for February 2026, security agencies dey now pursue full enforcement to deal wit pipo wey still get weapons illegally for di kontri.

Ghana joined the UN arms destruction day commemoration

Wia dis foto come from, GHANA INTERIOR MINISTRY

Wetin we call dis foto, Di small arms commission say dem decide to first 'disable' di firearms permanently bifor dem go recycle dem sustainably

Categories of weapons and firearms dem retrieve

Firearms – some of di firearms wey dem retrieve and odas wey security agencies don seize for dia operations include pistols, shotguns and odas firearms for hunting

Military-grade weapons – Di small arms commission open-source gun incident report show say civilians dey display military-grade weapons like AK-47 rifles, G3 rifles and M16 rifles during traditional and cultural celebrations, sometin wey dey worry.

Authorities say among di ova 4,000 firearms dem collect, be AK 47 assault rifles, M16 and oda type of rifles. Dis weapons no dey permitted to dey for di custody of citizens.

Locally manufactured weapons – blacksmiths and local artisans bin dey produce weapons wey dem dey sell for di black market. Authorities say some of weapons dem retrive for di gun amnesty programme be locally manufactured.

According to di interior ministry, ordinary citizens, some private security pipo, as well as local vigilantes bin dey part of those wey surrender dia illicit firearms and ammunition for di gun amnesty programme.

Odas like local artisans and traditional authorities also surrender some of dis weapons.

Since di end of di amnesty programme, di police don raid many places and pursue criminals wey dem seize more weapons.

Chief of staff cutting some of the funs

Wia dis foto come from, GHANA INTERIOR MINISTRY

Wetin we call dis foto, Authorities dey pursue pipo wey still illegally get weapons
proliferation of small arms is a major security issue in Ghana

Wia dis foto come from, GHANA SMALL ARMS COMMISSION

Wetin we call dis foto, According to di interior ministry, ordinary citizens, some private security pipo, as well as local vigilantes bin dey part of those wey surrender dia illicit firearms
The interior ministry and its allied agencies are poised to clamp down on illicit weapons

Wia dis foto come from, GHANA INTERIOR MINISTRY

Wetin we call dis foto, As at September 2025, 2.3 million weapons dey di hands of civilians according to data from di small arms commission
the small arms commission during the gun amnesty toured most parts of the country to sensitise communities about illicit weapons

Wia dis foto come from, GHANA INTERIOR MINISTRY

Wetin we call dis foto, Oga for di Small arms commission Dr Adam Bonaa say "dis exercise be important step to reduce gun violence and strengthen public safety."