Iran stand still for burial of late supreme leader Ayatollah Ali Khamenei for Mashhad

    • Author, David Gritten
  • Published
  • Read am in 5 mins

Huge crowds don gada for di streets of di holy city of Mashhad for di burial of Iran late supreme leader, Ayatollah Ali Khamenei.

Dem go lay Khamenei to rest for di shrine of Imam Reza, Iran holiest Shia Muslim site. E go mark di end of six days of public mourning ceremonies for five cities across Iran and neighbouring Iraq.

Di burial dey come afta exchange of strikes between Iran and US wey don threaten to pause one preliminary deal dem get to end di war wey kpai di Supreme leader.

Earlier, Iran Revolutionary Guards bin accuse US of bombing two bridges for di railway line from di capital, Tehran, go Mashhad overnight "as part of effort to scata" di funeral.

Khamenei and plenti members of im family bin die inside one Israeli strike on im residence for Tehran on 28 February, di first day of Iran war wit US and Israel.

Di son of di supreme leader, Mojtaba succeed am but nobodi don see am for public, as tori dey say e seriously injure for di same attack.

Di 56-year-old no follow for di funeral ceremonies for Tehran and Qom, and e no dey certain say e go attend di burial.

On Thursday morning, one plane wey carry di coffins of Ali Khamenei, im granddaughter, son-in-law, daughter and Mojtaba wife land for Mashhad from Iraq, wia huge crowds bin take part for di processions go two Shia shrines for di cities of Najaf and Karbala.

For afternoon, Iranian TV footage show thousands of mourners wey wear black dey waka along one main boulevard for central Mashhad. Many of dem dey wave di Iranian flags and red banners wey symbolise vengeance.

Some pipo also hold di fotos of di late supreme leader and placards wey dey call for di death of US President Donald Trump, plus dat of di Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu, wey togeda order di joint attack on Iran four months ago wey trigger di war.

Ontop di boulevard na banners wit official slogans wey include "We must rise".

"Di loss of di leader dey heavier pass losing our parents," Hoda, one 35-year-old housewife, tell AFP news agency. "Only di death of Trump and Netanyahu go ease our pain."

Later, one lorry wey dey carry Khamenei coffin slowly through di crowds towards di Imam Reza shrine, eventually reach di complex as night fall.

Imam Reza na di eighth Shia imam and di only one of di 12 pipo believe say dem bury for Iran.

Millions of pilgrims dey visit im mausoleum, wey date back to di 9th Century and wey get towering golden dome and minarets evri year.

Who be Ayatollah Ali Khamenei

Dem born Ayatollah Ali Khamenei for Mashhad, Iran second-largest city wey dey located for di northeast of di kontri. E study for seminaries for di city bifor e move go Qom, di centre of Iran Shia clerical establishment.

E dey appointed as supreme leader for 1989 afta di death of di Islamic Republic founding father, Ayatollah Ruhollah Khomeini.

During im 37 years in power, e maintain firm grip on Iran politics and di armed forces, and e suppress domestic challenges, sometimes violently.

E also consistently take hard-line positions on external matas, wey include confrontation wit di US and Israel.

Iran leadership want make di choreographed funeral ceremonies for Khamenei project unity and strength afta di war, wey kpai thousands of pipo, plus di mass protests for January, wen one crackdown by security forces bin leave thousands more pipo dead.

Renewed fight-fight wit US, however, spoil di public mourning.

Trump don warn say US attacks fit get "much worse" afta a second night of strikes on Thursday, wey di US military tok say na to degrade Iran ability to target commercial shipping for di Strait of Hormuz.

Di Revolutionary Guards say Iranian forces bin attack US military facilities and infrastructure for Kuwait, Bahrain and Qatar in response.

Three weeks ago, di US and Iran bin sign one memorandum of understanding (MoU) wey call for end to hostilities on all fronts and di reopening of di Strait of Hormuz. Di MOU also give dem two months to reach final deal wey cova Iran nuclear programme, US sanctions and permanent truce.

Last week, mediator Qatar tok say Iranian and US negotiators bin make progress for indirect tok-tok for Doha afta four days exchange of strikes. Dem add say dia next meeting go take place afta di conclusion of di ceremonies for Khamenei.

But on Wednesday, Trump tell tori pipo say im believe say di MoU now dey "ova".