You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Africa authorities say killing wey Ghana link to anti-immigration protests na 'fabricated tori'
South Africa police dey refute reports say one Ghanaian die during di 30 June anti-immigration protests, afta Ghanaian authorities condemn di killing of 40-year-old citizen for Cape Town.
Authorities of di rainbow nation also condemn wetin dem describe as "false information by Ghana about irregular migration for di kontri".
Di Govment of Ghana say di fatal shooting happun during di anti-immigration protests on 30 June, 2026.
But South African police and di Ministry of Justice and Constitutional Development tok BBC say di killing happun a day bifor di protest, wey e neva dey connected to di anti-foreigners protests.
Inside one statement, di Ghana Foreign Affairs Ministry confam say dem identify di deceased as 40-year-old Bashiru Isak, wey di shooting happun for Khayelitsha for Cape Town.
Di latest information dey come afta reports of looting of shops and attacks on African migrants for South Africa bifor and during di 30 June nationwide protests.
Di kontri say plans dey underway to repatriate di bodi of di deceased to im family for Ghana for burial, as di govment also report di mata to di police and oda agencies for South Africa.
Wetin Ghana govment tok about di incident
Di kontri foreign ministry say di report don shock dem well-well, especially afta many African kontris don demand protection for dia citizens by South African authorities bifor, during and afta di 30 June nationwide anti-immigration protests.
But reports of looting, attacks and harassment for some areas dey vex dis African kontris - especially Ghana, Nigeria and Malawi.
Ghana govment say dose wey dey responsible for dis latest killing gatz face di law.
"On di instruction of di foreign ministry, di kontri High Commission for Pretoria don file protest for di Department of International Relations and Cooperation wey dem also file complaint wit di South Africa police," di statement tok.
Ghana authorities say dem bin notify di family of di deceased, wey di govment demand for autopsy wey South African authorities don do.
Di foreign ministry say "Ghana dey demand full-scale investigation and arrest and prosecution of pipo wey dey responsible for dis killing".
Di 40-year-old victim according to tori na tailor wey bin dey stay for South Africa for 20 years.
Local media network for Ghana, JoyFm don report say di deceased bin die afta dem shoot am for im shop.
"Dem bin reportedly shoot Bashiru for im shop during di protest, im get three children - di eldest one reportedly dey 10 years old."
Ghana govment say plans dey underway to repatriate im bodi to im family for Ghana for burial.
"Di ministry dey extend dia condolences to di family of Bashiru Isak for dis tough time."
South Africa authorities say wetin Ghana tok na "fabricated tori"
South African police say di pesin wey die no dey connected to xenophobic attack during di 30 June protests.
Police tok di BBC say di death na from one robbery incident wey happun on Monday, 29 June, a day bifor di 30 June anti-immigration protests.
Police confam to di BBC say di 35-year-old man Kwaben Boagen die during di shooting incident for Nyanga township for Cape Town.
According to witnesses, di suspects enta one barbershop wia di deceased bin dey work wey dem demand money bifor dem shoot am.
"Crime report bin show say dem shoot di 35-year-old Ghanaian for di Nyanga Terminus for front of di NTG Hair Salon and shoe repairs around 15:45 on Monday."
Police tok for dia statement say emergency medical service pipo confam di death of di victim for di crime scene.
Di suspects now comot di scene, police no yet make any arrest.
Police also say di motive of di attack dey related to 'extortion'.
Di police say "di victim wey die bin dey stay for Khayelitsha but im dey work for Nyanga; post-mortem also bin dey underway by di Department of Health".
Di Department of International Relationship and Cooperation tok-tok pesin Clayson Monyela don describe di tori by Ghana authorities "fabricated tale" especially wen Ghana bin link di murder to di ongoing anti-immigration protests.
Police say dem no get any record of death for Khayelitsha as Ghana authorities bin tok for dia statement.
"We dey appeal to authorities for dis mata to provide details of di alleged Khayelitsha to di police to enable investigation," di South Africa police tok.
Inside anoda statement by di Ministry of Justice and Constitutional Development, di govment condemn wetin dem describe as "false information by Ghana authorities to paint South Africa as xenophobic".
Mmamoloko Kubayi wey bin dey chair di Inter Ministerial Committee on migration say "Ghana govment statement be factually incorrect".
Minister Kubayi add say "e dey concerning say Ghana authorities continue to communicate false information. Nobodi bin die for di 30 June protests, authorities deal wit di isolated criminal activities wey happun for parts of di kontri".
"Once again, di spread of false information to push di false narrative say South Africa be xenophobic, be unacceptable,"Mmamoloko Kubayi explain.
'Extortion robbery' na new criminal activity for South Africa wia pipo approach businesses and residents for places wia crime don plenti, to demand wetin dem call 'protection fee'.
For dis arrangement, dem dey convince dis businesses and residents say "pay us to keep di real criminals away".
Dis na form of harassment, wey police neva confam di nationality of pipo wey dey linked to dis new criminal activity, both di offenders and di victims.
South African Police confam looting and violence during protests, arrest ova 2000 pipo
Police don release statement wia dem confam various incidents of violence and looting for many parts of di kontri on 30 June.
Di police tok say "several districts for di Free State Province suffer incidents of public violence, looting and property damage, wey police respond to restore order and arrest pipo".
Odendaalsrus - Police say for dis area, looters bin target businesses wey lead to arrest of three suspects.
Thabong (Sunrise View area) - Seven shops dey looted wey dem scata two cars wey belong to South Africa police.
Vredefort - For dis area, police say dem loot 20 shops wey dem damage one police vehicle; dem arrest four suspects for 'public violence' wey dem gbab one pesin for 'malicious damage to property'.
Tumahole - Dem loot nine shops wey dem bin rob four houses for area wia dey rented by foreign nationals. Police say dem arrest for dis incidents but in total dem gbab 19 suspects during di looting, wey police seize several looted items, drugs, and one firearm.
To dey manage public disturbances for dis protests, di Free State Police carry out "massive operation wey involve all specialised police units, to target serious crime and illegal migration".
For dis operation, police gbab 2,153 pipo - di arrests wey relate to crime be 223, di ones wey dem arrest sake of police action na 146.
Police confam say dem also arrest 581 undocumented foreigners wey dem detain dem.
Police also make 382 drug-related arrests, while dem seize two firearms.
Free State police say dem bin monitor seven marches across di province, wey dem visit 505 premises, wey include businesses and tuckshops.
Di Free State SAPS Provincial Commissioner, Lieutenant General Thabang Lesia warn say "we go meet lawlessness, looting, and oda attacks for state property wit di full force of di law".
Ghana dey work to evacuate 900 more citizens as tension continue to rise
Meanwhile, govment say dem dey work to evacuate more dan 900 citizens wey register for voluntary repatriation.
Di High Commissioner Benjamin Quashoe tok say di process of screening and registration by di South African authorities bin delay di process.
"About 900 pipo don write dia names wit us, if you add dat number to di almost 1,000 pipo we evacuate already, dat na nearly 2,000 pipo."
Im add say "we don put some of dis Ghanaians for some accommodation wia we don tok police wia dem dey so say dem go protect dis location against attacks".
E neva dey clear wen di evacuation of di 900 pipo go happun, but wit di latest report of di killing of 40-year-old Bashiru, tension go dey rise again, especially as anti-immigration vigilantes and groups say dem go continue dia protests evri Thursday until dia govment fix dia economy, illegal migration crisis and odas.
Meanwhile, Ghanaians wey decide to continue to stay for South Africa dey advised to remain vigilant and avoid high-risk places.
Dem also dey advised to contact di Ghana High Commission 24-hour emergency numbers for help.
Ghana say dem go "continue to pursue diplomatic, consular and multilateral channels to protect lives and welfare of citizens abroad".