You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Expecting 84-year-old Adeboye to lead protests no make any sense' - Mike Bamiloye weigh on calls for RCCG leader to lead protest
Popular Nigerian gospel film producer and founder of Mount Zion Faith Ministries, Evangelist Mike Bamiloye, don lend im voice to defend di General Overseer of di Redeemed Christian Church of God (RCCG), Pastor Enoch Adeboye, afta mixed reactions follow di cleric comment on di security challenges wey di kontri dey face.
Di 84-year-old cleric on Tuesday bin share one video on im social media account wey don generate plenti debate online.
For di video, Pastor Adeboye wey be di leader of one of di largest Pentecostal Church for Africa bin suggest to di Nigerian govment to issue 90-day ultimatum to service chiefs to eliminate terrorism or resign from office.
Di video wey di General Overseer repost wey now don go viral na one wey e originally do for November 2025 for di middle of allegations say e dey campaign for one govment and dey loyal to one political party. Di video also clear accuse say e cancel one planned protest against insecurity.
To lend im voice to di trending video, di Christian filmmaker on im official Instagram account on Wednesday, knock pipo and bloggers wey dey drag and give false analysis on di cleric position.
Oga Bamiloye condemn dose wey dey expect Pastor Adeboye to lead protest at im age, as e add say di cleric don always speak against evil for di society.
"And for all dose wey dey expect 84-year-old man, Servant of God to lead a protest against govment, dis no make sense by di virtue of im age and by di Mandate of im Calling".
Di filmmaker also say dose wey dey claim say di religious leader lead protest against former President Goodluck Jonathan for 2010 no tok di truth of di mata, as no be di cleric call for di protest but di Christian religious bodisfor di kontri.
"Na di instruction of CAN and PFN for evri church to stage protest against insecurity for di kontri and e obey and lead im denomination too, just like some oda churches do."
Oga Bamiloye add say di major responsibility of di Church of God na to continually pray for di peace of di nation and di intervention of God for di govment.
Pastor Adeboye react to insecurity wey dey rise for Nigeria
General Overseer of RCCG Pastor Enoch Adeboye say na only advice wey dem fit give to di President Bola Tinubu, dem no go fit command am.
E dey tok on di insecurity issues for Nigeria wey don generate widespread reaction.
"Na only advice you fit advice di Commander- in-Chief, you no go fit command am, becos if you command di commander- in- chief den you go becom di Commander of di Commander-in- Chief and e no go make sense, but I don try, God na my witness," e tok for one video e share ontop im social media handle.
Di 84-year-old add say "If dem ask me to make suggestions, I go tell our govment quietly say make dem move fast and tell our security chiefs to get rid of dis terrorists within 90 days or resign".
Im tell im congregation say im beliv say dem don hear dis kain tok well-well and e no dey new to dem.
Im make reference to former Nigeria President, Muhammadu Buhari wey bin give dis type of order. Im add say di late president bin call di Service Chiefs dat time and im bin give dem three months.
Pastor Adeboye explain say even though di former Nigeria president no tok who bin give am di advice, im follow di advice but im no make sure say im complete am.
Pastor Adeboye confam say na im give Buhari dat advice and if to say im still dey alive pipo for ask am why im no follow di advice from beginning to di end.
Di pastor wey dey lead large congregation of Christians around di world give anoda advice to dis Tinubu administration.
"In case any of una know how to reach dem, make una make am clear to dem say no be only to eliminate di terrorists, make dem also eliminate dia sponsors no mata how influential dem fit be."
Di Pastor video begin trend afta di Redeemed Christian Church of God (RCCG) wey be one of di largest Pentecostal Church for Africa don clear di air on wetin dem call "false narratives" wey dey spread about di Church and di General Overseer.
Di church say tori say Pastor Adeboye bin campaign for di ruling All Progressives Congress (APC) govment no be true.
RCCG Public Relations Unit for one statement on dia official X account on Tuesday, 2 June clear am say Pastor Adeboye instead dey always encourage members of di RCCG to collect dia Permanent Voters Card and vote for anyone of dia choice.
Recently, di church bin enta public eyes as some Nigerians drag dem ontop one alleged planned protest wey dem cancel and di call from some pipo for di removal of Nigeria First Lady Remi Tinubu as Pastor for di church, plus oda tins.
Di church respond to di accuse and add say, "Pastor Adeboye and di RCCG no go dey defined by falsehood, and di church no go remain silent while inaccurate narratives dey repeatedly circulate as facts."
Pastor Adeboye cancel planned protest?
Recently, tori bin spread say di 84-year-old General Overseer bin cancel one protest against insecurity for di kontri and di kidnap of school children for Oyo State.
RCCG say dat no be true as wetin di cleric tok about di rally na di instruction wey di Pentecostal Church of Nigeria (PFN) give to all di churches wey dey under am.
"Pastor E.A. Adeboye bin only communicate di instruction of di Pentecostal Fellowship in Nigeria to members of di RCCG on di updated plan to get di grand finale of di three-day prayer programme for one centralised venue and hold rally around di venue."
Many pipo don drag di GO say e lead, carry placard and protest against di administration of former president Goodluck Jonathan, but for President Bola Tinubu administration, e silent as e no organise im members to rally against di insecurity kontri pipo dey face under di current administration.
Di church for dia response explain say di waka for Ebute Metta, wey Pastor Adeboye participate inside na part of one nationwide exercise wey di Christian Association of Nigeria (CAN) bin organise.
"Di church no organise di protest against President Goodluck Jonathan and e no in anyway dey connected to im administration," di statement tok.
Pastor Adeboye message during di waka dey clear and na say all lives mata to God. "Im placard emphasise di value of evri human life, regardless of religious affiliation. Di call na for di protection of innocent Nigerians, both Christians and Muslims", di statement add.
Di cleric also hold peaceful nationwide waka in response to di directive wey di Christian Association of Nigeria (CAN) issue during di administration of di late president Muhammadu Buhari.
"Churches across Nigeria bin dey instructed to hold peaceful waka afta service, to call di attention of di govment to di persistent killings of Christians and urging dem to take decisive action to protect lives.
Allegation say Pastor Adeboye intentionally dey quiet on tins wey dey happun for Nigeria
Di church also dismiss allegations say Pastor Adeboye intentionally dey silent on wetin dey go on for di kontri. RCCG say di cleric no dey silent.
Pastor Adeboye na one cleric wey dey vocal on national issues and wey dey always call govment attention to tins wey no dey go on well for di kontri. But, recently pipo don accuse am say e turn blind eye to Tinubu administration. Some allege say na becos of dia same ethnic group and religious affiliation wit di President wife, Oluremi Tinubu, wey be pastor for RCCG.
Di church for di statement clear am say di cleric on several occasions, don publicly address issues wey concern insecurity, corruption, economic hardship, elections, governance, plus di need for righteous leadership.
However, most times, e dey choose di language of moral guidance, prayer and counsel, instead of partisan political confrontation.
During di November 2026 Holy Ghost Service, Pastor Adeboye bin publicly advise di President of Nigeria ova di worsening security situation and di continued killing of innocent citizens by terrorists. E warn say govment gatz take urgent action bifor foreign powers find solid reason to intervene for Nigeria under di guise of combating terrorism.
E also say make govment give security chiefs clear ultimatum to decisively address di mata or vacate dia positions.
Calls for di removal of First Lady Oluremi Tinubu as Redeemed pastor
Recently, di church don face pressure to remove Nigeria First Lady Oluremi Tinubu as pastor for Redeemed Christian Church of God.
Pastor Adeboye say di church no go remove her from her position as she be ordained pastor for di church.
Di cleric wey give dis informate for di May Holy Ghost Service explain say di First Lady dey ordained as Assistant Pastor more dan ten years ago, long bifor her husband Bola Tinubu show any intention say im wan run for di presidency.
E clear am say di First Lady go through di full process of ordination and she no violate any of di church guidelines, as e add say di church no go bow to external pressure wey dey call for her removal.
Di church also clear am say di calls for di cleric to command di President and di First Lady on how to run di affairs of di kontri dey both unrealistic and unreasonable.
"Pastor Adeboye na clergyman, no be di Commander-in-Chief of di Armed Forces."
Di church also say Pastor Adeboye and RCCG no dey responsible for di current challenges di kontri dey face, RCCG no be political party. Di GO no hold any political office and no dey elected into govment. Lastly, di church no be di religious arm of any political party for Nigeria.