Ahmadou Al Aminou Lo replace sacked Senegal Prime Minister Ousmane Sonko wey become Speaker of Parliament
Sacked Senegal Prime Minister Ousmane Sonko become Speaker of Parliament as President Faye appoint Ahmadou Al Aminou Lo to replace am

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Ousmane Sonko, di former Prime Minister of Senegal wey President Diomaye Faye bin sack, don emerge di new Speaker of di kontri National Assembly.
Dis dey come as Faye announce di appointment of a new Prime Minister, Ahmadou Al Aminou Lo to replace Sonko.
Faye and Sonko na beta allies bifor and sake of Sonko popularity make Faye win di election for 2024. However, both men don dey quarrel for some time now and di quarrel reach di highest wit Faye sacking Sonko as Prime Minister last Friday.
Following dat development, di Speaker of di parliament Malick Ndiaye, anoda ally of Sonko, resign from di position on Monday, to make way for am to take ova di position.
Senegalese lawmakers elect Sonko as speaker during dia session dis Tuesday. Di Pastef party wey Sonko be di leader get majority for di National Assembly wit 130 seats out of 165.
Also, di Speaker of di National Assembly na di second highest political position for Senegal, and as Sonko don assume di position now, e fit reduce di ability of President Faye to get im way if e get any of im policy wey di parliament no support, analysts tok.
Di president no go fit dissolve di parliament until at least two years afta di last election - and e mean say any move to end di mandates of lawmakers by force bifor November dis year, go dey considered invalid.
Dis recent wahala between Faye and Sonko don further increase uncertainty ova di political future of Senegal, wey get big problem of debt wey dem dey owe.
Di 51-year-old Sonko get huge support across di kontri, especially among di young pipo, and e bin dey popular as di main pesin wey bin challenge di policies of di former President, Macky Sall.
Sonko for even win di 2024 presidential election for Senegal if no be say dem ban am from contesting sake of say e bin get court conviction on top accuse of defamation.

Wia dis foto come from, Ahmadou Al Aminou Lo/LinkedIn
Why Speaker Malick Ndiaye resign
Speaker of Senegal National Assembly, Malick Ndiaye, tender im resignation letter late on Sunday, 24 May, 2026, just two days afta President Bassirou Diomaye Faye comot Prime Minister Ousmane Sonko, im former paddy wey im and am don dey quarrel for long.
Speaker Ndiaye, for im resignation letter tok say di decision na "personal choice" and na for "di greater interest of di nation".
Ndiaye and Sonko na strong allies and analysts say im resignation dey strongly related to di sacking of di former Prime Minister.

Wia dis foto come from, Turkish Grand National Assembly/ Handout/Anadolu via Getty Images
Dis move by Ndiaye, according to sabi pipo, don clear di way for Sonko to contest for di position of di Speaker of di parliament and e dey expected to win am easily.
Di Pastef party wey Sonko be di leader dey control di parliament by 130 seats out of 165.
Sonko na di major opposition leader under di administration of former President Macky Sall, and e for win di presidential election if no be say dem ban am from contesting sake of say court bin find am guilty of defamation.
Both Faye and Sonko bin dey for prison ahead of di 2024 election, and na just 10 days to di election date wey dem come out.
Na within dat 10 days Faye take part for im campaign wit di slogan: "Diomaye moy Sonko, Sonko moy Diomaye" (Diomaye na Sonko, and Sonko na Diomaye), and e go on to win wit 54 percent of di vote.
Wetin go happun now?
Pastef party get di ogbonge majority for di Senegalese National Assembly and Sonko na di undisputed leader of di party.
For April dis year, di lawmakers pass law wey change di electoral code to tok say pipo wey get convictions for minor offences fit still dey eligible to run for di office of di president, and sabi pipo say na bicos of Sonko dem pass dis law so dat e go fit contest for di 2029 presidential election.









