Morocco defeat Scotland to revive dia hope for knockout stage of Fifa World Cup 2026

Wia dis foto come from, Ulrik Pedersen/NurPhoto via Getty Images
Morocco beat Scotland wit one goal to revive dia hope for knockout stage of di ongoing Fifa World Cup 2026.
Ismael Saibari put Morocco in front afta just 70 seconds, becoming di fastest goal so far for di tournament.
Scotland struggle to create clear-cut chance but all dia hope end in defeat as dem no get chance to equalise against strong Morocco side.
Morocco move up to second position for di group C table wit four points just behind Brazil wey dey lead di group sake of goal difference.
Scotland dey third position wit three points, but if dem fit waya Brazil to win, dem go go through to di knockout stage.
Wit just one game to go for di group stage, Scotland hope dey dia hand to progress to di next stage.
Head coach Steve Clarke say make di "footballing Gods dey smile down on us".
Di coach dey hope say one point fit confam dia progress out of Group C, but e no go be how dem start dia game against Morocco.
How Scotland vs Morocco take waka

Wia dis foto come from, Anadolu, Kevin C. Cox via Getty Images
During di first minutes of di game wit Morocco, Scotland get veri slow start.
Na di sloppy defending allow Ismael Saibari to give im side sensational lead inside di opening two minutes.
Scotland coach change im tactics wey e use for di last game victory against Haiti. E start wit Celtic defender Kieran Tierney for di left of midfield so e go fit mark Morocco captain Achraf Hakimi.
Dat plan dey pulled apart, though, wen centre-backs Grant Hanley and Jack Hendry allow Saibari to go behind dem and sensationally flash dat shot wey give Morocco di lead.
While Morocco wey draw wit Brazil for dia first game last weekend dey far superior for evri department, dem no too scata di Scotland team.
Scotland players get fine opportunity to equalise bifor di break but John McGinn fire one of im opportunities back-post.
Data chance dash di hope of di Scots bifor half-time, but by second half, dem carry dat spirit enta again as dem try claim one penalty but referee no give am.
Scotland dey frustrated as ref no award penalty in dia favour, but still, di strikers dey fire shots wey di Moroccan defenders dey block.
Scotland complain about spot-kick wen Scott McTominay hit di deck but referee no blow for dem.
Di Napoli midfielder deflect effort wen half of di stadium dey celebrate but di ball hit di side of di net.
All di attempts by Scotland to score goal wey go level di score sheet no work out.
From di worst start to hopeful and promising end, Scotland go carry dat hope into dia final group game against Brazil on Wednesday.
Morocco on dia part, go dey hope to beat Haiti for dia next meeting and dat go decide who dey go next stage.
Morocco start strong and fast against Brazil for di first game, all Scotland need to do na to hold bodi well at di beginning so dem no go fall behind early, but dem fall hand.
If to say Steve Clarke team fit remain competitive for long, dem for get chance to search for beta result.
Di right side partnership of Achraf Hakimi and Brahim Díaz make Morocco veri dangerous, while teenage midfielder Ayyoub Bouaddi and goalscorer Saibari don alreadi dey write dia names for good books of di Fifa World Cup.









